Exodus 40
40
Dem Build Di Tabanako Finish
  1Den God tell Moses: 2“For di first day for di first mont, yu go arrange di Tabanako, di tent where dem for dey do meetin. 3Yu go put di Testimony Box inside kon kover di box with curtain. 4Yu go bring di tabol inside kon put di tins wey bilong to am on-top; den yu go bring di lampstand inside with en lamps.
  5“Yu go put gold altar for di incense for di Testimony Box front kon put di curtain for di Tabanako gate. 6Yu go put di altar for di burnt ofrin for di Tabanako gate and di tent where dem for dey do meetin. 7And yu go put di basin between di tent where dem for dey do meetin and di altar, den pour wota inside. 8Yu go put di kourtyard round am kon put di curtain for di kourtyard gate.
  9“Make yu take di anointin oil, anoint di Tabanako and all di tins wey dey inside kon santify dem with all en tins and dem go dey holy. 10Den yu go anoint di altar for di burnt ofrin with all en tins kon santify di altar and e go bi di altar wey dey holy pass. 11Yu must anoint and santify di basin and en stand.
  12“Yu go bring Aaron and en sons kom di door-mot for di tent where dem for dey do meetin kon wosh dem with wota. 13Den yu go dress Aaron with di holy garments kon anoint and santify am make e for fit serve as my priest. 14Yu go bring en sons, dress dem with tunik 15kon anoint dem, just as yu anoint dia papa make dem for fit serve as my priests too and dia anointin go make dem kontinue di work thru-out dia generashon.”
  16Dis na wetin Moses do akordin to evritin wey God kommand am. 17So dem start to use di Tabanako for di first day for di first mont for di sekond year. 18Wen Moses start to use di Tabanako kon put di stands for dia place, e arrange di frames kon tie di bars. E still arrange di posts. 19Den e spread di tent on-top di Tabanako kon kover am, just as God kommand am.
  20E take di testimony stones kon put am inside di box, tie di poles for di box, den put di kover on-top. 21E take di box enter di Tabanako; hang di curtain wey dey protet am kon kover di Testimony Box, just as God kommand.
  22E put di tabol inside di tent where dem for dey do meetin for di nort side, outside di curtain. 23Den e set di bread on-top am for God front, just as God kommand.
  24E put di lampstand inside di tent where dem for dey do meetin opposite di tabol for di sout-side. 25And e put di lamps before God, just as God kommand am. 26E put di gold altar inside di tent where dem for dey do meetin for di curtain front 27den di incense wey get good smell, e kon burn am put, just as God kommand.
  28Den e put di curtain for di Tabanako door. 29E still put burnt ofrin altar for di Tabanako gate, di tent where dem for dey do meetin kon put di burnt ofrin and food ofrin for top, just as God kommand.
  30Den e put di basin between di tent where dem for dey do meetin and di altar kon pour wota inside to take dey wosh. 31Moses, Aaron and en sons go wosh dia hand and leg for inside. 32Anytime dem enter di tent where dem for dey do meetin or waka near di altar, dem go first wosh dia body, just as God kommand.
  33E set di kourtyard round di Tabanako and di altar, den put di curtain for di gate for di kourtyard. So Moses finish di work.
Kloud For Tabanako
  34Den di kloud kover di tent where dem for dey do meetin and God glory kon full inside di Tabanako. 35Moses nor fit enter di tent where dem for dey do meetin, bikos di kloud rest on-top am and God glory kover di Tabanako.
  36But wen ever di kloud komot from di Tabanako, Israel pipol go kontinue dia journey; 37but if di kloud nor komot, dem nor go-go anywhere until di day wen di kloud go komot. 38God kloud dey-dey di Tabanako for day time and na fire e dey bi for nite and evribody for Israel dey si am as dem dey travel.
      Currently Selected:
Exodus 40: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee



