YouVersion Logo
Search Icon

Exodus 33

33
Israel Pipol Komot From Mount Sinai
1God tell Moses, “Make yu and di pipol wey yu take komot from Egypt go di land wey I promise Abraham, Isaak and Jakob sey, ‘I go give una shidren-shidren.’ 2And I go send one angel go before una rish der kon drive Kanaan, Amor, Hit, Periz, Hiv and Jebus pipol komot der. 3Una dey go di land where milk and honey full. But I nor go dey with una, bikos una bi sturbon pipol and if I travel with una, I fit go distroy una for road.”
4Wen di pipol hear dis word, dem kon start to mourn and dem nor gri wear ear-ring or gold again. 5God tell Moses, “Make yu tell Israel pipol sey, ‘Una too sturbon. So, if I go with una, I fit vex distroy una. Naw make una remove all una gold and fine klot, even doh I still dey tink wetin I go do with una.’ ” 6So from di time wey Israel pipol komot from Mount Horeb, dem nor ever wear gold or ear-ring again.
God Present
7Moses take di tent kon stand am for outside for di place wey far pass for di kamp and e koll am, “Di tent where dem go for dey meet.” Anybody wey won si God, go-go di tent for outside di kamp.
8Wen Moses go di tent, all di pipol go get up kon stand for di gate for dia tent door and dem go dey look Moses until e enter di tent. 9Anytime Moses enter di tent, di pila with kloud go kom down kon stand for di gate and God go tok to Moses. 10Wen all di pipol si di pila with kloud for di gate, each pesin for en gate go stand up kon woship God. 11God go tok to Moses face-to-face, just as man dey tok to en friend. Den Moses go-go back to di kamp; but en yong savant Joshua wey bi Nun son, nor go komot from di tent.
God Promise
12Moses kon tell God, “Si, Yu don dey always tell mi sey, ‘Take dis pipol go dat land,’ but Yu neva let mi know who Yu go send follow mi. But Yu sey, ‘I know Yu by yor name and Yu always dey good for my eye.’ 13Naw, if really sey I dey good for yor eye, make Yu show mi yor way; so dat I go know Yu more-more kon kontinue to dey good for yor eye. Den I go si sey dis pipol, na yor pipol.”
14God ansa, “My present go-go with yu and I go give yu rest.”
15Moses sey, “If Yu know sey yor present nor go-go with us, den make Yu nor take us komot from here. 16How I go take know sey I dey good for yor eye, both mi and yor pipol, Israel? Nor bi if Yu go with us (dat is, mi and yor pipol), wi go dey difren from all di oda pipol for di world?”
17God tell Moses, “I go still do wetin yu tok, bikos yu dey good for my eye and I know yu by yor name.”
18Den Moses sey, “Make Yu show mi yor glory.”
19God ansa, “I go make all my goodness pass yor front and I go announce my name as Oga God to yu. I go show kindness to who I choose and I go show mesi to who I like show am to.” 20God still sey, “Yu nor go fit si my face, bikos nobody wey si my face go survive.” 21God kon sey, “E get one place near mi where yu fit stand put on-top one rock. 22And wen my glory dey pass, I go put yu for where open for di rock kon kover yu with my hand until I don pass. 23Den I go take my hand komot and yu go si my back, but yu nor go si my face.”

Currently Selected:

Exodus 33: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in