YouVersion Logo
Search Icon

Exodus 26

26
Tabanako
1“Make yu still make di Tabanako with ten curtain with fine linen wey dem weave with blue, purpol and red wool. Make yu make di curtains like angel wey get feada and na who dey design go do dis work. 2Each of di curtain go long rish forty-two fit and wide rish six fit. 3Make yu join five curtain togeda. 4Yu go take blue klot make ring for di curtain korna wey dey di end part for one set and like dis too, yu go make rings for outside di oda curtain korna for di sekond set. 5Yu go make fifty ring for one curtain kon make anoda fifty ring for di curtain end wey dey di sekond set, so dat di rings go hold one anoda. 6Den yu go make fifty gold hook take join di two set as one.
7“Make yu make kover for di Tabanako with eleven curtain. 8Di curtain go long rish forty-five fit kon wide rish six fit. 9Den yu go join five curtain togeda kon join di remainin six togeda. Fold di nomba six curtain two times for di Tabanako front. 10Yu go make fifty ring for di korna for di last curtain for one set and fifty ring for di korna for di curtain wey join di sekond set. 11Yu go make fifty bronze hook kon put di bronze hooks inside di rings, den join di tent togeda, so dat evritin go form one kover. 12Yu go hang di half tent curtain wey remain for di tent back. 13Di one and half fit for di curtain lengt wey remain for di two side, yu go use am kover di two side. 14Make yu take ram skin wey dem dye with red take make kover for di tent, den kover dis ram skin with fine leda.
15“Yu go still take akasia wood do two stand as frame for di tent. 16All di frame go long rish fifteen fit kon wide rish two fit three inches, 17with two tins wey kom out, so dat dem go fit join di frames togeda. All di frames go bi di same. 18So, make yu make di frame for di Tabanako and yu go make twenty for di sout-side 19kon make forty silva wey go dey under di twenty frame; two silva go dey under one frame, bikos of di two tins wey dem go do kom out from am. 20For di nort side for di tent, make yu make twenty frame 21with dia forty silva bottom and two go dey under di next frame. 22For di tent back wey face di west side, yu go make six frame. 23Yu go make two frame for di tent korna for di two back-side. 24For di two korna side, yu must doubol am for bottom, den kon finish di top as one ring and e go bi for di two korna. 25So na eight frame go dey with dia sixteen silva bottom and two for di bottom go dey under di next frame.
26“Den yu go take akasia wood take make some bar: five na for di frames for one side for di Tabanako 27and five bar na for di frames for di oda side. Yu go still make five bar for di frames wey dey di back-side wey face west. 28Di bar wey dey middle for where di oda frames dey, go long from one end go rish di oda. 29Make yu kover all di frames with gold kon make dia rings with gold, den make one place for di bars. Yu go still kover all di bars with gold.
30“Yu go build di tent as I show yu for di mountin.
31“Make one curtain with fine linen wey dem weave with blue, purpol and red wool kon draw di angel wey get feada inside. 32Den yu go hang am with gold hook for di four post wey dem make with akasia wood kon kover dem with gold. 33Hang di curtain under di hook for di tent roof and for di curtain back. Yu go put di Kovenant Box for der. Di curtain go separate di Holy Place from di Holy of Holy.
34“Put di kover on-top di Kovenant Box wey dey inside di Holy Place. 35Make yu put di tabol for outside di Holy Place and di lampstand go dey opposite di tabol near di tent kon face sout, den yu go put di tabol for di nort side.
36“For where dem go pass enter di tent, yu go make fine linen curtain wey dem weave with blue, purpol and red wool kon dekorate am with design. 37And yu go still make hooks for dis curtain and five post with akacia wood kon kover dem with gold. Den do five bronze bottom for dem.

Currently Selected:

Exodus 26: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in