YouVersion Logo
Search Icon

Exodus 2

2
Dem Born Moses
1For dis time, one man from Levi tribe marry one woman wey kom from di same tribe. 2Di woman get belle kon born boy. Wen e si sey di pikin fine well-well, e kon hide am for three mont, 3but as e nor fit hide am again, e take basket wey dem make with soft wood kon wrap am, so dat wota nor go enter inside. E put di pikin inside kon put am near di grass dem wey dey River Nile korna. 4Di boy sista stand for far dey look, so dat e go si wetin go happen to am.
5Den Fero dota kom di river kon baf and as en savants dey waka for di river korna, at wons di king dota kon si di basket for where di grass dem dey. So e send one among en savants go bring am kom. 6Wen e open di basket, e kon si di boy inside dey kry. Fero dota sorry for di pikin kon sey, “Dis go bi one Hibru woman pikin.”
7Den di pikin sista kon ask Fero dota, “Yu wont make I go find one woman among di Hibru wimen wey go fit kare for dis pikin for yu?”
8Fero dota ansa, “Make yu go.” So di yong girl kon go bring di pikin mama kom.
9Fero dota tell di woman, “Go take kare of dis pikin for mi and I go pay yu for di work.” So di pikin mama karry am kon go kare for am.
10Wen di pikin don big rish, di woman kon karry am go give di king dota as en pikin and e name am, “Moses” bikos e sey, “Na wota I for si am.”
Moses Run Go Midian
11Wen Moses don mature, e komot go visit en Hibru pipol. For der, e kon si how en pipol dey sofa, bikos of di work wey dem dey do. Den Moses si as one Egypt man dey beat one Hibru man wey bi en own pesin. 12As Moses si sey nobody dey look dem, e attack, kill and beri di Egypt man.
13Wen e kom outside di next day, e si two Hibru men dey fight. So e kon tell di one wey do bad sey, “Wetin make yu dey beat yor broda like dat.”
14Di man ansa, “Who sey make yu kom judge us? Yu dey plan to kill mi as yu take kill dat Egypt man?”
Den Moses kon dey fear, so e tink kon sey, “True-true, pipol don know wetin I do.” 15Wen Fero hear about di matter, e kon dey fine Moses make e kill-am.
So Moses run from Fero go Midian land kon go stay near one well. 16Naw, Midian priest get seven girls wey dey kom draw wota from di well to take feed dia papa animals. 17So some shepad kom drive di girls komot from di well, but Moses fight for dem kon give dia animals wota.
18Wen di girls rish house, Jetro, dia papa kon ask, “Wetin make una kwik kom house today?”
19Dem ansa, “Na one Egypt man save us from doz shepad, den e draw wota for us kon still give di animals drink.”
20Di man ask en dotas, “Na where dis man dey and wetin make una leave am for der? Make una go koll am kom, so dat e go follow us chop today.”
21Moses agri to stay with dem and di man kon give en dota, Zipporah to Moses as en wife. 22Moses wife born boy and Moses koll am, “Gershom” bikos e sey, “Na strenja I bi for dis land.”
God Koll Moses
23Afta sometaim, Egypt king kon die, but Israel pipol still dey kry, bikos dem dey sofa well-well. So dem kry well-well to God for heaven. 24God hear dia kry and E remember en kovenant wey E make with Abraham, Isaak and Jakob. 25God si as dem dey sofa, so E kon dey sorry for dem.

Currently Selected:

Exodus 2: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in