Exodus 10
10
Eight Wahala: Plenty Lokust
1Den God kon tell Moses, “Make yu go meet Fero, bikos I don make en and en savants heart strong, so dat I go fit show dem all dis my mirakles. 2All dis tins dey happen, so dat yu go fit tell yor shidren and grand-shidren how I take fool Egypt pipol with my mirakles, make dem for know sey na mi bi God.”
3So Moses and Aaron go meet Fero kon tell am, “God wey bi Hibru pipol God sey: ‘Na how long e go take yu before yu go honbol yorsef for where I dey? Make yu let my pipol go woship mi! 4But if yu nor gri let dem go, I go make lokust full yor kountry tumoro. 5Di lokust dem go plenty well-well kon kover evriwhere and nobody go si ordinary groun. Dem go chop all di tins wey remain from wetin di ice-blok rain distroy and dem go chop all di trees for field. 6Di lokust dem go full yor house, yor savants house and all Egypt pipol house and e go plenty pass wetin una papa and grand-grand papa don ever si since wen dem dey di land kon rish today!’ ” Den Moses turn kon waka leave Fero.
7Fero savants ask am, “Na how long dis man go dey trobol us? Make yu free di pipol make dem go serve di Oga wey bi dia God. Yu nor know sey Egypt don distroy finish?”
8So dem bring Moses and Aaron kom back kon si Fero and e tell dem, “Make una go serve di Oga una God. But na wish pipol dey follow una go?”
9Moses ansa am, “Wi go-go with awa yong and old pipol; all awa shidren and all awa animals, bikos wi dey travel go do sakrifice to take honor di Oga awa God.”
10Den Fero tell dem, “I swear with God sey, I nor go let una take una wimen and shidren follow body! E klear sey yu really get wiked plan! 11So make only di men go serve Oga God, bikos dat na wetin yu wont.” Den Fero drive Moses and Aaron komot for en front.
12God tell Moses, “Make yu stresh yor hand face Egypt, so dat di lokust go kom kover evriwhere and dem go chop all di plants wey dey grow wey di ice-blok distroy remain.”
13So Moses stresh di stik wey dey en hand face Egypt. At wons, Oga God make one strong breeze from east blow kom Egypt, both for day and nite. For morning, di breeze from east don karry lokust enter di land. 14Di lokust kover evriwhere for Egypt, plus di arias wey dey near der. Di wahala strong well-well and dem neva si any lokust like dat before and dem nor go ever si any lokust like dat again. 15Di lokust kover di groun kon make am black, den chop all di plants and fruits wey dey for di tree wey di ice-blok distroy remain. No leaf remain for di tree and all di plants and grass, die finish for Egypt.
16Den Fero kwik-kwik sey make dem koll Moses and Aaron and e tell dem, “I don sin against di Oga una God and against una! 17Make una forgive mi for dis last time and pray to di Oga una God, so dat E go remove dis sofa from mi.”
18So Moses komot from Fero front kon go pray to Oga God. 19Den God send anoda strong breeze from di sea and e karry all di lokust enter di Red Sea. No lokust remain for Egypt again. 20But God still make Fero heart strong and e nor gri free Israel pipol.
Nine Wahala: Darkness
21Den God tell Moses, “Make yu stresh yor hand go heaven, so dat darkness go kover Egypt and dem go feel am, bikos e go tick well-well.” 22So Moses stresh en hand go heaven and for three days, tick darkness kon dey evriwhere for Egypt. 23Nobody fit si each oda and nobody fit stand up komot for where e dey for three days. But Israel pipol get lite for where dem dey.
24Den Fero send for Moses kon tell am, “Make una go serve di Oga una God, both una and una family, but una animals go dey here for Egypt.”
25But Moses ask am, “Yu go give us di animals wey wi go take do sakrifice and burnt ofrin to di Oga wey bi awa God? 26All awa animal must go with us and no one go remain. Wi must take di animals go serve awa God. Until wi rish der, wi nor go fit know wetin to take serve awa God.”
27But God still make Fero heart strong and e nor gri free dem. 28So Fero tell Moses, “Make yu komot from where I dey and nor ever kom si mi again, bikos any day wey yu si my face again, yu go die!”
29Moses ansa, “Make e bi as yu tok! I nor go si yor face again.”
Currently Selected:
Exodus 10: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee