YouVersion Logo
Search Icon

Deutronomi 22

22
Difren Laws
1Wen una si una neighbour animal dey waka lost, make una nor trowey una eye; una must riton am go give di owner. 2If di owner nor dey stay near una or una nor know who e bi, make una take am go una house until di owner go kom find am, den una must gi-am back en animal. 3Na di same tin una go do to donkey, klot or any oda tin wey una neighbour lost wey una si. Make una dey ready to always help una neighbour.
4Wen una si una neighbour donkey or melu dey faint for road, make una nor trowey una eye or waka pass am; instead make una make sure sey una help di animal.
5Make woman nor wear klot wey bi man own and make man nor wear woman klot, bikos anybody wey dey do dis kind tin, dey make di Oga una God vex.
6If una si bird house for tree or for groun and yong birds or eggs dey inside with dia mama for der, make una nor take di mama from en shidren. 7Make una free di mama, but una fit take di shidren. Make una do like dis, so dat e go dey well with una and una go get long life.
8If una build new house, make una build guide round di roof, so dat dem nor go sey una kill pesin in kase pesin fall from di top.
Klean Tins
9Make una nor plant two difren seed for una vineyard; if not, all di fruit and di seed wey una plant, go skata.
10Make una nor klear una farm with donkey and melu togeda.
11Make una nor wear klot wey dem use wool and linen take make.
12Una must fold una kover klot for di four korna.
To Dey Klean For Marriage
13If anybody marry woman kon sleep with am den 14e porshu am for publik kon sey, “Na wen I marry dis woman, I know sey e nor bi virgin.” 15Den di woman papa and mama must bring proof kon give di eldas for di town gate sey, dia pikin na virgin. 16Di girl papa go tell dem, “I give my pikin to dis man as en wife and naw, e don rijet am. 17E dey curse di girl sey, ‘I don know sey yu nor bi virgin.’ But dis klot show sey my pikin na virgin, before e marry am.” Den, dem go spread di girl bed shit for di eldas front. 18Di eldas go take di man kon ponish am. 19Dem go still tell am make e pay 100 silva to di woman papa, bikos na for publik e for curse di woman sey e nor bi virgin. Den di woman go still bi di man wife and e nor go fit sey make di woman pak komot from en house.
20But if wetin di man tok na true and e show sey di woman nor bi virgin, 21den dem go take di woman go en papa door-mot. For der, di men for di town go stone am die. E don kommit bad sin for Israel, bikos e dey sleep with difren men wen e dey en papa house. Like dis, una go remove evil from among una.
22If dem katch anybody dey sleep with anoda man wife, both of dem must die; like dis, una go remove evil from Israel.
23If virgin don dey engage to one man and anoda man for di town kon sleep with am, 24una must bring di two of dem kom di town gate kon stone dem die. Una go stone di girl die, bikos e nor kry wen di man dey sleep with am and una go kill di man, bikos e sleep with di woman wey en broda suppose marry; like dis, una go remove evil from among una.
25But if di man meet di woman for outside di town kon force and rape am, den na only di man go die. 26Una must nor do anytin to di woman, bikos e nor do anytin wey go make dem kill-am. Dis one na di same tin as wen pesin attack and kill anoda pesin, 27bikos di man meet am for field and di woman kon dey shaut, but nobody dey der to save am.
28If one man si virgin wey dey engage kon force and rape am and dem katch dem. 29Di man wey rape di woman go pay 50 silva give di woman papa and di woman go bi en wife, bikos e don dis-virgin am. E nor go ever fit porshu di woman komot en house till e die.
30Make nobody marry en papa former wife, bikos dat na disgrace to en papa.

Currently Selected:

Deutronomi 22: pcm

Highlight

Copy

Compare

Share

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in