Deutronomi 19
19
Law About Kilin
1Wen di Oga una God don distroy di pipol wey E won give dia land to una, una go take di land kon stay for dia towns and house. 2Den for di centre for di land wey God dey give una, make una keep three town for der. 3For di aria for di land wey God dey give una as una own, una go measure and divide am into three, so dat pesin wey kill anoda pesin fit run go der.
4If pesin kill anoda pesin by mistake, without sey dem kworel or dey fight before, di pesin fit run go any of di town go stay. 5For ezample, may bi pesin go forest with en neighbour go kut wood. Den one of dem kon karry di axe make e kut di tree and di axe head komot from di wood wey hold am kon kill di oda pesin. For dis matter, dat pesin wey kill di pesin fit run go one of dis towns and e go dey save. 6Bikos if di town too far for am, before e go run rish der, di pesin wey dey vex sey dem kill en pesin fit porshu di pesin kon kill-am. Dis pesin deat nor good, bikos na mistake e take kill pesin. 7Na dis make mi sey, make una keep three town wey pesin go run go and e go dey save.
8And if di Oga una God don make una land big, just as E promise una grand-grand papa kon give una all di land wey E promise dem 9and una dey obey all di kommand wey I dey give una today (wey bi to love di Oga una God and always do as E tok), dat time, make una add three towns join di first three. 10Una must nor kill innocent pesin for di land wey di Oga una God won give una, bikos dat go make una dey guilty.
11But if pesin hate en neighbour kon hide for korna dey wait am, so dat e go attack and kill-am, den run go dis towns, 12di pesin wey old pass for en family go sey make dem bring am kom, so dat dem go kill-am too. 13Make una nor sorry for dat kind pesin! Pipol wey dey kill pipol wey nor do anytin, make una komot dem from Israel, den evritin go dey well with una.
Witness
14Wen una rish di land wey di Oga una God dey give una, make una nor ever tif anoda pesin land or komot di boundary stone for where una grand-grand papa sey make dem put am.
15Make una nor hold anybody sey e do bad, if na only one pesin bi witness. Di trut for di matter bi sey, two or three pesin must sey dem si wetin happen.
16If pesin kom outside kon tok wetin e nor si about anoda pesin, 17den, both who tok and who dem dey tok about go kom God present kon tok before di priest and di judge wey dey der. 18Den di judge go handle di matter well-well. If di oda pesin lie for en broda head, 19den di deat wey e won make e broda die, na en go die-am. Like dis, una go remove all dis bad pipol among una. 20Den di rest pipol go hear wetin happen and dem go kon dey fear to do doz kind bad tins. 21Anybody wey dey guilty, make una nor sorry for am! Una matter must bi life-for-life, eye-for-eye, tit-for-tit, hand-for-hand and leg-for-leg.
Currently Selected:
Deutronomi 19: pcm
Highlight
Copy
Compare
Share
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee