Acts 23
23
1Paul look di kansol pipol kon tell dem, “My brodas, I dey live my life with klean mind for God eye kon rish today.” 2Bikos of wetin e tok, Ananias wey bi di High Priest kon orda di pipol wey stand near Paul sey make dem slap am for mout. 3So Paul tell am, “God go slap yu too, yu wey dey pritend! Yu sidan dey judge mi with di law, yu nor dey disobey di law wen yu sey make dem slap mi?” 4Di pipol wey stand near am kon sey, “Yu dey curse God High Priest?” 5Paul ansa, “I nor know before sey naim bi di High Priest, bikos God word sey, ‘Make yu nor tok bad about di pesin wey dey rule yor pipol.’ ”
6Den wen Paul know sey some pipol wey dey der na Sadusi and odas na Farisees, e kon shaut make di whole kansol hear, “My brodas, I bi Farisee, na Farisee pesin born mi. Dem dey judge mi today, bikos I put hope sey pipol wey don die go wake again!” 7Wen e tok dis tin, kworel kon start between di Farisee and di Sadusi pipol and di kansol kon divide. 8(Bikos Sadusi pipol bilive sey pipol wey don die, nor go wake again and dem nor bilive sey anytin like angel or spirit dey sef, but Farisee pipol bilive all dis tins.) 9So kworel kon start between dem and some oga for di law matter wey bi Farisee pipol kon stand up dey oppoz di Sadusi pipol sey, “Wi nor si any bad tin wey dis man do. Una know weda na spirit or angel tok to am?” 10Wen di argument kon too mush and di kommanding offisa dey fear sey dem go tear Paul to pieces, e kon orda en sojas make dem enter di meetin and karry Paul komot for der by force.
11For nite for di next day, Jesus kon stand near Paul tell am for vishon, “Make yu nor fear, bikos as yu don testify about mi for Jerusalem, na so yu go still do for Rome.”
Dem Plan To Kill Paul
12Wen morning rish, some Jew pipol kon gada dey make bad plan and dem swear sey dem nor go chop or drink anytin until dem kill Paul. 13Di pipol wey make dis bad plan pass forty. 14Dem go meet di priest oga dem and di eldas tell dem sey, “Wi don swear sey wi nor go chop anytin until wi kill Paul. 15So make una and di kansol tell di kommanding offisa make e bring Paul kom meet una, like sey una one judge en kase again. Wi ready to kill-am, before e go rish dis place.”
16But wen Paul sista pikin hear about dis plan, e run go inside di barrak go tell Paul. 17Paul koll one soja oga kon tell am, “Take dis boy go meet di kommanding offisa, bikos e get sometin wey e won tell am.” 18So di soja oga take di boy go meet di kommanding offisa kon sey, “Paul, wey dey prison, sey make I bring dis boy kon meet yu, bikos e get sometin wey e won tell yu.” 19Di kommanding offisa whole di boy for hand go one korna kon ask am, “Wetin yu won tell mi?” 20Di boy ansa, “Jew pipol dey plan sey dem go ask yu make yu bring Paul kom di kansol tumoro, like sey dem won ask am kweshon again. 21So make yu nor allow dem deceive yu, bikos dem pass forty wey hide for bush one kill-am. Dem don swear sey dem nor go chop or drink anytin, until dem don kill Paul. Naw, dem dey wait for yu to gri for wetin dem won ask yu.” 22So di kommanding offisa tell di boy make e dey go kon warn am sey, “Nor tell anybody sey yu don ripot dis matter give mi.” 23Den e koll two soja oga kon tell dem, “For nine oklok dis nite, make una ready two hundred sojas wey go-go Caesaria, plus seventy, wey go ride horse and two hundred, wey go karry spear. 24Make una arrange horse wey Paul go sidan put, so dat una go fit guide am well-well go meet Felix wey bi di govnor.” 25E rite leta like dis:
26“From Klaudius Lysias to Govnor Felix, I salot yu! 27Di Jew pipol seize dis man and dem nearly kill-am before I rish der with my sojas. Wi kon save am from dia hand, bikos I find out sey, e bi Roman citizin. 28Bikos I won know di offence wey e kommit, I kon karry am go dia kansol. 29I kon si sey en offence, na about wetin dem dey argue about for dia law, but e nor do anytin wey rish to kill-am or put am for prison. 30Wen one pesin tell mi sey dem dey plan to kill-am, naim I send am kon meet yu at wons and I still orda di pipol wey dey akuiz am make dem kom tok wetin e do for yor front.”
31So di sojas karry Paul for nite until dem rish Antipatris, just as dia oga kommand dem. 32Di next day, di two soja oga leave di men wey dey ride horse follow Paul and dem kon go dia barrak back. 33Wen di men wey dey ride horse rish Caesaria, dem kon take Paul and di leta give di govnor. 34Wen di govnor don read di leta, e ask dem where Paul from kom. Wen e hear sey e kom from Silisia, 35e kon sey, “I go hear yor kase wen di pipol wey akuiz yu rish here.” Den e orda sey make dem guide Paul for inside Herod palis.
Currently Selected:
Acts 23: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee