Acts 17
17
Paul And Silas For Tesalonika
1Afta dem pass Amfipolis and Apollonia, dem kon rish Tesalonika where one Jew sinagog dey. 2Paul go meet di Jew pipol for di sinagog as e dey do before and for three Sabat Day, e kon dey tish dem God word, 3dey show dem how God word sey Christ must sofa and e go raiz from grave. E tell dem, “Dis Jesus wey I dey tell una about so, naim bi di Christ.” 4Some among dem wey bilive kon join Paul and Silas and many Greek pipol wey dey fear God and some big-big wimen, join dem too. 5But di Jew pipol dey jealous, so dem kon gada aria boys wey dey waka about for market, take form gang to skata di town. Dem attack Jason house, bikos dem tink sey Paul and Silas dey der, so dat dem go bring dem out kon take dem go di town hall. 6Wen dem nor si dem, dem kon drag Jason and some for en brodas go meet di town oga, dey shaut, “All dis pipol wey don start wahala for di world, don rish here too 7and Jason put dem for en house like visitor! Dem dey do wetin dey against Caesar law, dey tok sey anoda king dey wey en name bi Jesus Christ!” 8Dem kause konfushon among di pipol wey gada and di town oga dem wey hear all dis tins. 9Afta di oga dem don kollect money from Jason and di brodas, dem kon allow dem go.
Paul And Silas For Berea
10At wons, di brodas send Paul and Silas go Berea for nite. Wen dem don rish der, dem kon go di Jew sinagog. 11Dis Jew pipol get betta mind pass di ones wey dey for Tesalonika, bikos dem open mind take bilive di message and dem dey read God word evriday to shek weda all di tins wey dem hear, na true. 12Na so many of dem take bilive, even with some big-big men and wimen wey bi Greek. 13But wen di Jew pipol wey dey for Tesalonika hear sey Paul don rish Berea dey prish God word, dem kon go der go kause wahala and spoil di pipol mind. 14Naim di brodas send Paul go di wotaside, but Silas and Timoti still stay for Berea. 15Di pipol wey follow Paul, escort am go rish Atens and afta, e orda dem sey make Silas and Timoti kom meet am kwik-kwik for der, so dem kon go back.
Paul Dey Atens
16As Paul dey Atens dey wait for dem, e kon dey vex for en spirit, bikos e si sey na so-so juju full di town. 17So e tok to di Jew and Gentile pipol wey dey fear God wey dey inside di sinagog and e still tok to evribody wey dey di market. 18So some wise men wey dey learn Epikurean and Stoik kon dey tok with am and some sey, “Wetin dis mumu and toku-toku tink sey e know wey e won tell us?” Some still sey, “E bi like sey e dey prish about some gods from anoda tribe.” (Dem tok so, bikos e dey prish di Good News about Jesus Christ and en resureshon.) 19So dem take Paul go Areopagus kon tell am, “Wi beg, make yu tell us about dis new tin wey yu dey tish so? 20Bikos di tins wey yu dey tok, wi neva hear am before and wi like to know wetin dem mean.” 21(Atens pipol and odas wey dey der, nor get any oda work pass make dem sidan dey tok story about any new tin wey dey happen.)
22So Paul stand for Areopagus front kon sey, “My pipol wey dey for Atens, I si sey una like God matter well-well. 23Bikos as I waka round dey look all di tins wey una dey woship, I even si one shrine wey dem rite put sey: ‘To di god wey pipol nor know.’ So wetin una dey woship wey una nor know, naim I kon tell una about today. 24God wey make di world and evritin wey dey inside, wey bi di Oga God for heaven and eart, nor dey stay inside house wey human being build 25and E nor wont make human being gi-am sometin like sey E nid anytin, bikos naim dey give life and air wey wi dey breath. 26Na thru one man E make all di tribes wey dey di world and E tok di time and place where dem go find God rish, 27so dat as dem dey look for God, dem go si am, even doh E nor dey far from all of us. 28Bikos na inside am wi dey live, waka, get life and some of una wey dey rite poem tok sey, ‘Wisef na God pikin.’ 29So, as e bi sey wi bi God pikin, make wi nor tink sey God bi like image wey human being use gold, silva or stone take make. 30God don forgive us for di time wen wi nor know wetin wi dey do, but naw, E dey kommand pipol for evriwhere sey make dem turn from sin kom meet am, 31bikos E don choose one day wey E go take judge di world with raitiousness thru di man wey E choose and show evribody wen E raiz am from deat.”
32Wen di pipol hear sey pipol go raiz from deat, some kon dey laf, but odas sey, “Yu go tell us dis matter again.” 33So Paul kon komot from Areopagus. 34But some pipol wey bilive Christ kon join am. Inside dis pipol wey bilive so, na Dionysius wey bi memba for Areopagus and one woman wey dem dey koll Damaris, with oda pipol wey join dem.
Currently Selected:
Acts 17: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: