YouVersion Logo
Search Icon

Acts 14

14
Paul And Banabas Go Ikonium
1For Ikonium, Paul and Banabas go inside di Jew sinagog and dem prish sotey many Jew and Greek pipol kon bilive God word. 2But di Jew pipol wey nor gri bilive, gada di Gentile pipol kon spoil dia mind against Paul and Banabas. 3Di apostles stay der tey well-well and dem tok with boldness about God, wey show sey dia message about en goodness na true, bikos E kon give dem pawa to do many mirakles and wonders. 4But di pipol wey dey di town kon divide; some dey di Jew side and some dey di apostle side. 5Di Gentile and di Jew pipol (with di oga dem wey dey rule dem) kon dey try to sofa and stone di disciples, 6but wen Paul and Banabas know about am, dem kon run go Lystra and Derbe wey dey for Lykaonia and all di aria wey dey near der 7and dem kon kontinue to dey prish for der.
Paul And Banabas Go Lystra
8For Lystra, dem meet one man wey nor fit waka since wen dem born am. 9Di man dey listin to Paul as e dey tok. Wen Paul look am for eye kon si sey e get faith wey go fit heal am, 10e tell am, “Stand up.” Di man kon jump up and e bigin waka. 11Wen di pipol si wetin Paul do, dem kon shaut for Lykaonia language sey, “Awa gods don turn to human being kom meet us.” 12Dem start to koll Banabas, “Zeus” and Paul, “Hermes”, bikos na Paul dey lead dem. 13Di priest wey dey woship di god wey dem dey koll Zeus wey en shrine dey outside di town kon bring melu and flowers kom di town gate; so dat en and all di pipol go sakrifice give di apostles. 14Wen Banabas and Paul hear about di tin wey di pipol won do, dem shaut, tear dia klot kon run go meet di pipol sey, 15“Why una won do dis kind tin? Wi too na human being like una! Wi kon tell una di Good News, wey go make una turn from sin kom meet God, wey make heaven, eart, sea and all di tins wey dey inside dem. 16Before-before, E let difren tribes dey do as dem like, 17but E nor stop to do good for una, E dey give una rain from heaven and food from groun, so dat una go chop and belle go sweet una.” 18But as Paul and Banabas tok rish, dem nor fit stop di pipol make dem nor do di sakrifice. 19But afta some Jew pipol wey kom from Antiok and Ikonium don win di pipol mind, dem kon stone Paul, drag am komot from di town, bikos dem tink sey e don die. 20And as di disciples gada round am, e get up kon waka go back to di town. Di next day, en and Banabas kon komot go Derbe.
Paul And Banabas Go Antiok Back
21Afta dem don prish God word for dat town and many pipol don turn from sin kom meet God, dem kon go back to Lystra, Ikonium and Antiok. 22Dem enkourage di disciples sey make dem get heart and make dem kontinue to dey bilive sey, “Wi go must sofa well-well for pipol hand, before wi go fit enter God Kingdom.” 23Wen dem don choose eldas wey go lead di bilivers for di difren-difren church, dem kon pray and fast sey, make God protet dem. 24Dem kon leave Pisidia go Pamfilia 25and wen dem don prish for Perga, dem kon go Atalaya. 26From der, dem enter ship go Antiok, where dem for first pray for dem, for di work wey dem just finish naw. 27Wen dem rish Antiok, dem gada di pipol kon tell dem all di tins wey God use dem do and how E open road for Gentile pipol to bilive. 28So dem stay der for sometaim with di bilivers.

Currently Selected:

Acts 14: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in