YouVersion Logo
Search Icon

2 Timoti 2

2
Betta Soja For Christ
1So yu, my pikin, make yu dey strong for di grace wey Christ dey give. 2Di tins wey yu hear mi tok for pipol present, make yu tish oda pipol wey yu trust sey dem dey ready to tish odas. 3Make yu dey ready to sofa as mi and odas dey sofa, so dat yu go bi good soja for Christ. 4Nor-tin koncern sojas with tins wey ordinary pipol dey do; if not, e nor go do wetin en oga wont. 5Bikos anybody wey dey run race, nor go fit win unless e follow di rule wey dey di game. 6Farmer wey work well-well, naim suppose get di first share for di harvest. 7Make yu tink about wetin I dey tok so and Christ go help yu to undastand evritin.
8Remember Jesus Christ wey kom from David family; di pesin wey God raiz from deat; bikos na so e bi for di message wey I dey prish 9and na dis Good News make mi dey sofa, sotey dem kon put mi for prison like tif; but dem nor fit put God word for prison! 10So I dey ready to bear di sofa, as long as e go save doz wey God don choose inside Christ with glory wey go dey forever and ever. 11Dis word na true:
If wi die with am,
wi go live with am too.
12If wi bear with am,
den wi go reign with am too
and if wi sey wi nor know am,
en too go sey, e nor know us.
13Weda wi get faith for am or not,
Christ go still bi who e bi
and e nor go shange.
Worker Wey God Choose
14Make yu remind evribody about dis tins, den make yu kommand dem for God present sey, make dem nor dey argue about words, bikos doz kind tins nor dey good and e fit konfuse doz wey dey listin. 15Make yu do evritin wey yu fit do, so dat God go si yu as betta pesin. Dey do yor work well as pesin wey nor dey shame, but dey ready to esplain God word wey bi trut. 16Make yu nor put mout for yeye tok, bikos pipol wey dey do doz tins, dey far from God. 17Dia word dey spread like diziz and na dis tin happen to Hymenaeus and Filetus. 18Dem leave di trut kon dey sey resureshon don happen already and like dis, dem don make some pipol fall from di faith. 19But God strong foundashon still stand and dem rite put sey, “God know en pipol and evribody wey bi Christ own, must stop to do evil.”
20Wen yu go rish man house, nor bi only gold and silva tins dey der, but tins wey dem use wood and klay take make still dey der too and some dey make di house fine and odas nor good at-all. 21So if yu keep yorsef without fault, yu go bi betta pesin wey Christ fit use as e dey do en good work.
22Make yu run from doz tins wey dey hongry yong pipol to do, so dat yu go please God forever. Den yu go fit love and stay for peace with odas wey dey serve God with klean heart. 23I dey tell yu again sey, make yu nor put mout for yeye word, bikos yu know sey dis kind tin dey kause kworel. 24Pesin wey bi Christ savant nor dey kworel, instead e must dey good with evribody; must sabi tish well-well and get patient with sturbon pipol. 25E must dey gentol as e dey korrect pipol wey dey oppoz en prishin and God fit let dis pipol turn from sin kom meet am, so dat dem go know di trut. 26Den dia sense go korrect and dem nor go fall enter devil trap again. Bikos devil don katch dem put inside en trap before, so dem dey do anytin wey e wont.

Currently Selected:

2 Timoti 2: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in