YouVersion Logo
Search Icon

2 Samuel 9

9
David And Mefiboshet
1One day, David ask, “E get anybody wey remain for Saul family? If e dey, I go like do good for am, bikos of Jonatan.”
2E get one savant for Saul family wey dem dey koll Ziba and dem tell am make e go meet David. David kon ask am, “Na yu bi Ziba?”
E ansa, “Yes sir! I bi yor savant.”
3David ask am, “E get anybody wey remain for Saul family wey I go show respet and dey kind to, just as I promise God sey I go do?”
Ziba ansa, “E still get one Jonatan pikin wey remain, but e nor fit waka again.” 4So David ask am, “Where e dey?” Ziba ansa, “E dey for Makir wey bi Ammiel pikin house for Lo-Debar.”
5Den David sey make dem go bring am kom.
6Wen Mefiboshet wey bi Jonatan pikin and Saul grand-pikin rish der, e show respet to David kon bow for en front.
David koll am, “Mefiboshet!”
E ansa, “My oga, I bi yor savant.”
7David tell am, “Make yu nor fear. I go dey kind to yu, bikos of Jonatan wey bi yor papa. I go give yu evritin wey bi Saul, yor grand-papa own and anytime wey yu kom my tabol, I go welkom yu.”
8Mefiboshet bow again kon sey, “Oga, I nor betta pass dog wey don die, why yu dey good to mi like dis?”
9Di king koll Ziba wey bi Saul savant kon sey, “Evritin wey bilong to Saul and en family, I dey give dem to Mefiboshet wey bi yor oga grand-pikin. 10Yu, yor shidren and yor savants go work for di land wey bi yor oga family own kon harvest and provide food for Mefiboshet family. But Mefiboshet ensef, go always kom chop for my tabol.” Ziba get fifteen shidren and twenty savant.
11Ziba ansa, “I go do evritin wey my king kommand.” So Mefiboshet kon dey chop for di king tabol like sey e bi king pikin.
12Mefiboshet get one son and en name na Mikah. All di pipol for Ziba family kon bi Mefiboshet savant. 13So Mefiboshet wey nor fit waka kon dey stay for Jerusalem and dey chop for di king tabol.

Currently Selected:

2 Samuel 9: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in