2 Samuel 5
5
David Rule Judah And Israel
1Den all di tribes go meet David for Hebron kon tell am, “Wi bi yor own flesh and blood. 2Before-before wen Saul still bi awa king, yu lead Israel pipol for war and God promise yu sey yu go rule en pipol and bi dia king.”
3Wen all di leaders for Israel meet King David for Hebron, David setol with dem and dem kon make am king for Israel.
4David na thirty years wen e bikom king and e rule for forty years. 5E rule Judah pipol from Hebron for seven and half years; e rule Israel pipol for Jerusalem and Judah for thirty-three years.
6Time kon rish for David and en men to attack Jerusalem. Jebus pipol wey dey der, tink sey David nor go fit win di town. So dem tell David, “Yu nor go fit enter here, even blind pipol and cripple, go fit win yu.” 7But David win Zion take and dem kon dey koll am, “David Town.”
8David ask en men dat day, “E get anybody for here wey hate Jebus pipol rish mi? Make wi kill dem? Den, make una pass di wota go kill doz poor and blind cripple.” Na dis make dem sey, “Doz wey dey blind and cripple, nor fit enter God house.”
9Afta dem don kapture der, David stay der kon koll am, “David Town.” E build house round am and e start from di dry land go rish di east side for di hill. 10David kon dey strong evriday, bikos Oga God wey dey mighty, dey with am.
11King Hiram for Tyre kon send business men go meet David, e send cedar woods with karpenters and doz wey dey do stones go meet David make dem take build di palis. 12So, David kon know sey God don make am king for Israel and E dey make en kingdom prosper, bikos of en pipol.
13Wen David don komot from Hebron go Jerusalem, e kon get many wifes, girl-friends and shidren. 14Di shidren wey dem born for am for Jerusalem na: Shammua, Shobab, Natan, Solomon, 15Ibhar, Elishua, Nefeg, Jafia, 16Elishama, Eliada and Elifelet.
Dem Win Filistia Pipol
17Dem tell Filistia pipol sey dem don make David king for Israel, so dia sojas kon ready to go fight am. Wen David hear am, e kon go di aria wey dey save. 18Filistia pipol kamp for Refah Valley. 19David kon ask God, “Make I attack Filistia pipol? Yu go help mi win dem?”
God ansa, “Yes! Make yu attack dem! I go give yu viktory!”
20So David go Baal-Perazim and e win Filistia pipol for der. E sey, “God don break-pass my enemies like flood.” So dem kon koll di place, Baal-Perazim. 21Wen Filistia pipol dey run, dem run leave dia juju and David and en men kon karry dem komot.
22Filistia pipol kon go Refah Valley go stay again. 23David ask God again and E ansa, “Nor attack dem from here, but go round make yu ready to attack dem from di oda side near where Balsam trees dey. 24Wen yu hear mashin sound on-top di trees, make yu attack, bikos I go mash go front go win Filistia sojas for yu.” 25David do wetin God kommand and e drive Filistia pipol from Gibeah go rish Geza.
Currently Selected:
2 Samuel 5: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee