YouVersion Logo
Search Icon

2 Samuel 24

24
David Kount Di Pipol
1God kon dey vex for Israel pipol again and E make David bring trobol kom meet dem. God tell am, “Make yu go kount Israel and Judah pipol.”
2So David orda Joab wey bi di sojas oga, “Make yu go round Israel tribe with yor ofisas; from one end to anoda for di kountry kon kount di pipol. I won know how dem plenty rish.”
3But Joab ansa di king, “My king, make di Oga wey bi yor God make dem plenty hundred times pass as dem bi naw and yu go leave long kon si wen E go do am, but wetin make di king won kount di pipol?”
4But di king make Joab and en ofisas obey en kommand, den dem komot go kount Israel pipol.
5Dem cross Jordan River go kamp for di sout-side for Aroer land, di town for di valley wey dey Gad aria centre. From der, dem go di nort side for Jazer and 6from der, dem kon go Gilead and Kadesh for Het aria. Den dem go Dan and from Dan, dem kon go west for Sidon side. 7Dem go di sout-side for Tyre town wey dem fence kon rish all Hiv and Kanaan pipol town and dem stop for Beersheba for Judah sout.
8So wen dem don waka for nine monts and twenty days, dem kon kom back to Jerusalem, bikos dem don travel round di kountry.
9Dem tell di king about all di men wey fit do soja work and dem bi 800,000 from Israel and 500,000 from Judah.
10But wen David don kount di pipol finish, en heart kon dey judge am, den e tell God, “I don kommit big sin for dis tin wey I do! Abeg, make Yu forgive mi. Na foolish tin I do so.”
11Den God tell Gad wey bi David profet, “Go tell David sey I dey gi-am three tins and make e choose one of dem 12and I go do anytin wey e choose.”
Wen David wake-up di next day, 13Gad go meet and tell am wetin God tok, so e kon ask, “Wish one yu wont make God do? Three years wey honga go dey di land; three monts wey una go take run from una enemies or three days wey bad sickness go dey yor land? Naw, make yu tink am kon tell mi di ansa wey I go-go give God.”
14David ansa, “I dey for bad kondishon, but I nor wont make men ponish mi, instead make only God ponish us, bikos E get mesi.”
15So God kon send bad sickness kom Israel, wey last from dat morning go rish di time wey E choose. From one end go rish di oda end for di kountry, na 70,000 pipol die for Israel. 16Wen Oga God angel won distroy Jerusalem, God kon shange en mind sey E nor go ponish di pipol again, so E tell di angel wey dey kill dem, “Make yu stop! E don do!” Dat time, di angel dey Araunah wey bi Jebus pesin farm.
17David si di angel wey dey kill di pipol and e tell God, “Na mi dey guilty, na mi bi di pesin wey do wrong. Wetin dis poor pipol do? Make yu ponish mi and my family.”
18Dat day, Profet Gad go meet David kon tell am, “Make yu go Araunah farm kon build altar for der for di Oga yor God.” 19David obey and e do evritin wey Profet Gad tell am. 20Wen Araunah look kon si di king and en ofisas dey kom meet am, e liedan for groun for David front 21kon ask, “My king, why yu kom here?”
David ansa, “I kom buy yor farm make I for build altar put for God, so dat di sickness go stop.”
22But Araunah ansa, “My king, make yu take am! Make yu use am do anytin wey yu like kon burn dis melu give God for di altar. Make yu use dia yoke and dis firewood for di ofrin.” 23Araunah give di king evritin kon sey, “Make di Oga wey bi yor God asept yor ofrin.”
24But di king ansa, “No! I nor go fit give di Oga my God, sakrifice wey I nor pay anytin for.”
So e buy di farm and di melu for fifty silva koins. 25Den e build altar for der kon give God burnt and fellowship ofrin. So God ansa en prayer and di sickness for Israel kon stop.

Currently Selected:

2 Samuel 24: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in