2 Samuel 19
19
Joab And David
1Dem kon tell Joab sey David dey kry and mourn for Absalom. 2So, instead make di sojas dey happy sey dem win, all of dem kon dey mourn, bikos dem hear sey di king dey kry for en pikin. 3Dem kwayet enter di town with shame like sojas wey dem win for war. 4Di king kover en face bigin kry dey sey, “O-o my pikin! O-o my pikin Absalom! Absalom my pikin!”
5Joab go di king house kon tell am, “Today, yu don disgrace yor men, di men wey save yu, yor shidren, wifes and yor girl-friends. 6Yu dey oppoz doz wey love yu kon support doz wey hate yu! Yu don make am klear sey yor ofisas and men know mean anytin to yu. I si sey yu go dey happy if to sey na wi die and Absalom dey life. 7Naw, make yu go make yor men heart strong. I use God name take swear sey if yu know go meet dem, nobody go stay here with yu dis nite. Na dat go bi di worse wahala wey yu go ever si for yor life.”
8Den di king get up go sidan for di gate. Wen dem tell all di pipol sey di king sidan for di gate, all of dem kon go meet am. But all di men for Israel don go back to dia house.
David Go Back To Jerusalem
9All di pipol for Israel kon dey kworel among demsef sey, “King David save us from awa enemies. E save us from Filistia pipol, but naw, e don run komot from di kountry bikos of Absalom. 10Wi anoint Absalom make e bi awa king, but dem don kill-am for war. So why wi nor go-go bring David back?”
11David hear wetin Israel pipol dey tok, so e send Zadok and Abiatar wey bi priest make dem go ask Judah leaders, “Why una go bi di last to go bring di king kom back to en palis? 12Na una bi my relashon, my flesh and blood, why una go bi di last tribe wey go bring mi kom back?” 13David still tell dem make dem tell Amasa, “Una bi my own relashon, from today go, I dey put yu for Joab place make yu rule my sojas. Make God ponish mi if I nor do wetin I tok!”
14So wetin David tok, enter Judah men heart and dem obey am kon send message go meet en and all en ofisas make dem kom back. 15Wen David dey go back, e kon si Judah men for Jordan River and dem kom Gilgal kon escort am cross di river.
David And Shimei
16For dat time, Shimei from Benjamin tribe wey bi Gera pikin wey dey stay Bahurim kon run go Jordan River go meet David. 17E take 1,000 men from Benjamin tribe, Ziba wey bi savant for Saul family, en fifteen sons and twenty savants go meet di king for Jordan River. 18Dem escort di king and en pipol cross di river and dem do evritin wey di king wont. As di king won cross, Shimei fall for di king front 19kon sey, “My king, abeg, make yu forget all di bad tins wey I do dat day wey yu komot from Jerusalem, nor kount am against mi or tink am at-all. 20My oga, I know sey I don sin and na dis make mi bi di first pesin from Josef tribe wey kom meet yu, my king.”
21Abishai wey bi Zeruaya pikin kon sey, “Make dem kill Shimei, bikos e curse di pesin wey God choose to bi king.”
22But David tell Abishai and Joab en broda, “Who make una judge? Yu won give mi trobol? Na mi bi Israel pipol king naw and nobody go kill Israel pesin today,” 23Den e tell Shimei, “I promise yu sey nobody go kill yu.”
David And Mefiboshet
24Den Mefiboshet wey bi Saul grand-pikin, kom meet di king. E neva wosh en leg; kut en hair or wosh en klot since di time wey di king komot from Jerusalem till naw wey e dey kom back with viktory. 25Wen Mefiboshet meet di king from Jerusalem, di king tell am, “Mefiboshet, why yu nor follow mi go?”
26E ansa, “My king, yu know sey I nor fit waka. I tell my savant make e karry mi for donkey follow yu, but e run leave mi. 27E tell di king lie about mi, but yu bi like God angel, so make yu do wetin dey good for mi. 28E good make di king kill all my papa family pipol, but yu give mi pawa make I take chop for yor tabol. I nor get rite to ask for any oda tin from di king again.”
29Di king ansa, “Make yu nor tok again. I don tok before sey, yu and Ziba go divide Saul propaty.”
30Mefiboshet ansa, “Make Ziba take evritin! My king, as yu kom house save, dat one don do for mi.”
David And Barzillai
31Barzillai wey kom from Gilead still kom from Rogelim make e for escort di king cross Jordan River. 32Dat time, Barzillai na eighty years; e get money well-well and e feed di king wen e dey for Mahanaim. 33So di king tell am, “Make yu follow mi go Jerusalem and I go kare for yu.”
34But Barzillai ansa. “I nor go dey dis life tey again, why I go follow my king go Jerusalem? 35I don old rish eighty years and nor-tin dey make mi happy again, I nor dey taste or enjoy wetin I dey chop or drink and I nor dey hear pipol wen dem dey sing again. So if I follow yu go, na wahala I go just bi to yu. 36Dat kind big reward nor fit mi. So I go follow yu pass Jordan River small. 37Make yu let mi go house go die near my papa and mama grave. Si Kimham my pikin, make e serve yu. My king, make e follow yu, den do wetin yu know sey dey good for am.”
38Di king ansa, “I go take am follow body kon do wetin yu wont for am. I go do anytin wey yu ask.”
39Den David and all en men cross Jordan River. E kiss and bless Barzillai and Barzillai kon go back to en house.
Judah And Israel
40Wen all di men for Judah and half of di men for Israel don escort di king cross, David kon go Gilgal. Kimham wey bi Barzillai pikin, follow am go.
41Den Israel pipol go meet di king kon sey, “Awa king, wetin make awa brodas for Judah hide escort yu, yor family and yor men cross Jordan River?”
42Judah men ansa, “Wi do am, bikos di king na one of us. So, wetin make una dey vex? Nor bi sey e don pay for awa food or give us anytin.”
43Israel pipol ansa, “Even doh David bi one of una, wi get am ten times, pass as una get am. Why una dey look us like sey wi bi small pikin or sey wi nor mean anytin? Make una nor forget sey, Na wi first sey make dem bring di king kom back!”
But wetin Judah men dey tok, strong pass di mout wey Israel men dey make.
Currently Selected:
2 Samuel 19: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: