YouVersion Logo
Search Icon

2 Korintians 9

9
How To Give
1I nor nid to rite to una about how to help God pipol wey dey Jerusalem, 2bikos I know sey una one help dem. I always dey boast give Masidonia pipol sey, una wey dey Akaia, dey always won help and una don ready to give money since last year. And di way wey una dey won help, don make some for dem won help too. 3But I dey send dis brodas kom meet una to make sure sey una dey ready; as I don tell dem before sey, una don already kollect money. So make una nor let shame katch mi, as I dey boast about una. 4But if anybody for Masidonia follow mi kom meet una, den e si sey una neva ready to give, shame go katch us, (I nor go tok too mush) bikos wi trust una. 5Naim make mi beg dis brodas make dem go for my front before di time go rish and make dem help una arrange di money wey una promise, so dat una go do am with una mind and nobody go force una. 6Na wetin I dey tok bi dis; Pesin wey plant small, go harvest small, but di pesin wey plant plenty, go harvest plenty. 7Make each of una give as e plan for en mind; nor bi with regret or like sey dem force am, bikos God love pesin wey dey give with happiness. 8God go provide evritin wey una nid. Den, una go always get evritin wey una nid and di one wey una go fit give odas. 9Just as dem rite for God word, “E don skata for evriwhere, e don give to poor pipol and en raitiousness, go dey forever.” 10Bikos na God dey give seed to farmer and provide bread wey pipol go chop. Like dis too, E go provide and di tins wey una nid, go plenty well-well and dem go last forever. 11E go make una get enough money for evritin, so dat evritime, una go fit dey give well-well and di pipol wey una give money, go always dey tank God. 12Bikos dis work wey una dey do so, nor just dey help only God pipol, but e dey always make pipol, tank God. 13Bikos of una work, pipol go praiz God, bikos una dey obey Christ word wey una bilive and una dey share evritin wey una get with good mind. 14So, bikos of God big grace wey E give una, pipol dey pray for una with strong love. 15Na dis make us dey tank God for dis gift wey pesin mout nor fit tok.

Currently Selected:

2 Korintians 9: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in