YouVersion Logo
Search Icon

2 Korintians 13

13
Paul Visit Korint Again
1Na di third time wey I dey kom visit una bi dis. If dem sey pesin do bad, two or three pipol must sey, na true, before pipol go bilive am. 2Wen I dey with una for my sekond visit, I tell una wey dey sin before about dis tins. Even doh I nor dey with una naw, I dey tok am again sey, if I kom again, I nor go sorry for anybody, but I go ponish am, 3bikos una sey make I show sey Christ dey tok thru mi. Christ nor dey weak to una, bikos e show en pawa among una. 4True-true, bikos e nor show en pawa, na dat make dem fit nail am for cross, but e dey alive naw, bikos of God pawa. Aldo wi dey weak with am, but wi go dey alive togeda with am, bikos of God pawa wey wi get. 5Make una test unasef to know weda una still dey inside di faith; e good make una shek unasef well-well! Una nor know sey Christ dey inside una? May bi una don fail di test! 6I hope sey una go know sey wi neva fail di test! 7Wi dey pray to God make una nor do anytin bad; wi nor dey do am to show sey wi pass di test, but make una for do wetin good, even if e bi like sey wi fail di test. 8Wi nor go fit do anytin against di trut, but na di trut go make us do evritin. 9Belle dey sweet us wen ever wi dey weak and una dey strong. And na wetin wi dey pray for bi dis, “Una go get evritin wey una suppose get.” 10Na dis make mi dey rite all dis tins since I nor dey with una, so dat wen I kom, I nor go vex for una bikos of di authority wey I get and God give mi dis authority to build; nor bi to distroy.
Final Advise And Greetin
11Finally my brodas and sistas, make una use happiness dey do tins as dem suppose bi. Make una take heart, dey greet each oda and live togeda for peace and di God wey get love and peace, go dey with una. 12Make una greet each oda for Christian way. 13All God pipol for here dey greet una. 14Make di grace wey awa Oga God Jesus Christ give us and di love wey God get for us, plus di Holy Spirit fellowship, dey with una.

Currently Selected:

2 Korintians 13: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in