2 Korintians 12
12
Paul Vishon
1E good to dey boast, even doh gain nor dey inside. I go still dey tok about di vishon and revelashon wey Jesus Christ show mi. 2Fourteen years ago, I know one man wey bi Christ savant. Weda na for vishon or Fisical, I nor know, but God know. God karry am go di heaven wey high pass. 3And I know dis man (but na only God know weda e dey for en body or for spirit). 4God karry am go paradise and e hear tins wey dey too holy to tok; tins wey God nor give human being pawa to tok. 5Na dat pesin make mi dey boast and I nor go boast about mysef, escept di tins wey show sey, I nor dey strong. 6Even if I won boast, I nor go bi fool, bikos na trut I go still tok, but I nor do am make anybody for tink sey na mi know pass, bikos e si and hear mi dey tok 7about di betta tins wey I si for vishon. Make I for nor dey karry body up, God put sometin inside mi, wey bi Satan messenja, so dat e go dey trobol mi. 8Na three times I ask Christ sey, make e take dis tin komot from my body. 9But e tell mi, “Di grace wey I give yu strong rish, bikos my pawa dey show wen yu dey weak.” So, I go boast well-well about how I nor dey strong, so dat Christ pawa go dey show for my body. 10I dey happy as I dey weak with all di curse, trobols, ponishment and wahala wey I dey sofa bikos of Christ, bikos anytime wey I dey weak, na dat time, I dey-dey strong.
11I don turn to fool! Na una force mi, bikos una suppose to praiz mi. Even if I nor bi anytin, e nor get anytin wey doz una “supper apostles” take betta pass mi. 12True-true for una present, wi do mirakles and wonders to show sey wi bi apostles too. 13Bikos di way wey dem trit us worse pass di oda church, escept sey I nor dey put my load for una head. Make una forgive mi for dis tins wey I do! 14Si, for di third time, I don ready to kom visit una and I nor go put my load for una head, bikos na una I wont and nor bi wetin una get. Nor bi pikin suppose pay for dia papa and mama food, but na papa and mama, dey pay for dia pikin food. 15I go dey happy to spend all my money and even my life, as long as una soul go dey save. Una love for mi dey small, bikos my love for una plenty? 16Even if e bi like dat, I nor put my load for una head. But dem sey, bikos I bi wayo pesin, I dey deceive una! 17I nor play anybody wayo thru di pesin wen I send kom meet una, abi I dey lie? 18Abeg Titus make e visit una and I send dat broda make e follow am kom. Dem play una wayo? Nor bi di same mind wi awasef take follow una? Abi nor bi di same way wi dey bihave? 19May bi una dey tink sey wi dey tok dis tins to defend awasef. No! Wi dey tok to una like dis as Christ savant and na God bi awa witness. Evritin wey wi dey do, na to make una strong. 20Bikos I dey fear sey wen I kom, I nor go like wetin I go si and una nor go like as I go tok. I dey fear sey una go dey kworel, dey jealous each oda; dey vex; dey tink of only unasef; dey tok bad about each oda; dey do aproko; dey karry body up and dey bihave anyhow. 21I dey fear sey wen I kom again, God go disgrace mi for una front. And I go kry, bikos many of una still dey sin. Una neva turn from sin kom meet God; una neva turn komot from di ashawo and yeye life wey una dey live.
Currently Selected:
2 Korintians 12: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: