YouVersion Logo
Search Icon

2 Korintians 10

10
Authority Wey Paul Get
1Naw, mi Paul (I kwayet wen I dey with una, but my mout dey sharp naw wen I don leave una). Christ wey nor dey karry body up, wey dey gentol, 2I take am beg una, so dat wen I kom, I nor go nid to tok with vexnashon about pipol wey si us like yeye pipol (bikos I dey fear sey na so e go bi). 3Bikos even doh wi dey for dis world, wi nor dey fight as pipol wont am. 4Di tins wey wi take dey fight, nor bi dis world own, but na God make am strong, so dat wi go fit skata all di strong place where wiked pipol dey. Wi dey skata trobol; 5pipol wey dey karry body up; doz wey nor wont make odas know God and as wi dey do like dis, pipol dey obey Christ. 6And wen una don show sey una dey fear God, wi go always dey ready to ponish doz wey dey disobey God. 7Na only tins wey eye fit si, naim una know. If anybody dey sure sey e bilong to Christ, make e tink about am again: If e bilong to Christ, den wi na Christ own too. 8Bikos if I boast small about di authority wey Jesus give us make wi take build, instead of to distroy una, I nor go shame to do am. 9I nor wont make una dey fear, bikos of wetin I rite, 10bikos some pipol dey sey, “En letas dey heavy and get pawa well-well, but if yu si am for groun, e nor get pawa and e nor even fit tok well.” 11Make doz pipol know sey, “Wetin wi tok for leta wen wi nor dey with una, wi dey do am wen wi dey with una.”
Wetin Paul Do
12Wi nor go kompare awasef with doz wey sey dem good well-well or kon put awasef for di same group. But wen dem dey measure and kompare demsef with demsef, e dey show sey dem nor get sense. 13But wi nor go boast pass as wi suppose boast; wi go boast akordin to di work wey God give us and una dey inside dat work too. 14Wi nor dey do awa work pass as wi suppose do am wen wi dey with una, bikos na wi bi first to bring Christ message kom meet una. 15Wi nor dey boast anyhow about di work wey oda pipol do, but wi dey hope sey as una faith dey grow well-well, awa work among una go big, just as God share am give us, 16so dat wi go fit prish di gospel for oda kountries wey far pass una own. So make wi nor boast about di work wey odas do for oda aria. 17But pesin wey won boast, make e boast about di work wey Jesus do. 18Bikos nor bi who praiz ensef dey rite, but na di pesin wey God like to praiz.

Currently Selected:

2 Korintians 10: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in