YouVersion Logo
Search Icon

1 Timoti 4

4
Timoti Ministry
1Di Spirit tok sey for di last days, some pipol go leave di faith kon dey bilive lie-lie spirits and follow wetin demons dey tish. 2Dis pipol dey lie and na wayo dem sabi do and dia mind don skata. 3Dem dey tish sey, e nor good to marry or chop some kind food. But na God kreate dis food and E sey pipol wey bilive di trut fit chop am afta dem don tank am. 4Bikos evritin wey God kreate, dey good and wi nor suppose rijet any food, so-far wi don tank God for am, 5bikos God word and prayer don make am klean.
6If yu give all dis kommand to di brodas and sistas, yu go bi good savant for Christ, bikos yu don feed yorsef with God word, wey bi di spiritual food and naim bi di good tishing wey yu dey follow. 7But make una rijet lie-lie and yeye story. Instead make una dey train unasef with betta words from God. 8Fisical trainin dey good, but na to know God good pass, bikos yu go get reward for dis life and di one wey dey kom.
9Dis na true word and e good make evribody asept am with betta mind. 10Na dis make wi dey work hard and dey struggol, bikos awa hope dey with God wey dey alive and E dey save evribody, especially doz wey bilive am.
11Make yu tish di pipol dis tins and make sure sey, dem do dem. 12Nor let anybody opress yu bikos of yor age; but make yu show ezample to doz wey bilive thru yor word, karata, love, faith and as yu pure rish. 13Until I kom back, make yu dey read God Word for church, dey enkourage di bilivers and tish dem. 14Nor stop to dey use di spiritual gift wey yu get; bikos yu get am thru profesy, wen eldas put hand for yor head dey pray.
15Make yu dey learn dis tins; dey do am with all yor mind, so dat pipol go si as yu dey progress. 16Make yu wosh as yu dey live yor life and di tins wey yu dey tish. Get patient, bikos if yu dey do like dis, yu go save yorsef and doz wey dey listin to yu.

Currently Selected:

1 Timoti 4: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in