YouVersion Logo
Search Icon

1 Timoti 2

2
Prayer For Evribody
1First of all, I tell una make una dey pray, ask and tank God for evribody. 2Make una pray for kings and doz wey dey rule, so dat wi go fit live for peace, get betta karata and good life with fear for God. 3Dis kind tin good and na wetin God awa Savior dey like, 4bikos E wont make evribody dey save and undastand di trut. 5Bikos na only one God dey and na Jesus Christ wey kom as human being, bi di pesin wey dey bring God and human being togeda. 6E die so dat evribody go dey free. Na dis message God go give di world, wen di time don rish. 7Na dis tins make God choose mi as prisha, apostle and tisha to Gentile pipol, so dat I go prish faith and wetin bi trut (na true word I dey tell una so, I nor dey lie). 8So, I wont make evribody dey pray for evriwhere, dey raiz dia holy hand without vexnashon or kworel.
Wimen Karata
9I wont make wimen dey dress well with sef kontrol. Nor make yeye hair style; nor wear too mush gold or stones and klot wey dear well-well. 10Instead, make dem get good karata as wimen wey dey fear God, suppose bi. 11Make wimen dey kwayet and listin well as dem dey learn. 12I nor allow woman tish or give dem authority ova men. Make dem kwayet dey listin, 13bikos na Adam God first kreate, nor bi Eve. 14And nor bi Adam, Satan deceive. Satan deceive di woman and na so sin take kom dis world. 15But God go save di woman wen e won born, so-far e kontinue to get faith, love, holiness and dey kontrol ensef.

Currently Selected:

1 Timoti 2: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in