YouVersion Logo
Search Icon

1 Tesalonians 4

4
Life Wey God Wont
1Finally, my brodas and sistas, wi dey ask and beg una bikos of Christ sey, as una don hear from us about how una suppose live as God wont (as una dey do naw), make una kontinue to dey live like dat. 2Una know di kommand wey wi give una thru Christ.
3Na wetin God wont bi dis: Make una dey holy; komot hand for bad tins; nor sleep with who nor bi yor wife or husband. 4Una wey bi man, make una dey live with una wife for holiness and with respet, 5nor bi to dey follow who yu nor marry, just as Gentile pipol wey nor know God dey do. 6Make nobody shit en Christian broda or make am vex, bikos na God go fight for di pesin wey yu shit and wi don tell una before and wi still dey warn una sey, God go really ponish pipol wey dey do like dat. 7Bikos God nor koll us to live yeye life, but na to live holy life. 8So, anybody wey rijet wetin wi tok; nor bi human being authority e rijet, but na God wey give una en Holy Spirit.
9No nid to rite give una about love for una fellow Christians, bikos God ensef don tish una about how una suppose love each oda. 10And una really dey show love to di Christian brodas and sistas for Masidonia. My brodas and sistas, wi dey beg una sey, make una kontinue to dey do like dat.
11Make una dey do well, so dat una go live kwayet life; dey mind una own business and dey work with una hand as wi kommand una before. 12Like dis, doz sinnas go dey respet una and una go get evritin wey una nid.
13Awa brodas and sistas, wi wont make una know di trut about doz pipol wey don die, so dat una nor go dey sad like pipol wey nor get hope. 14Since wi bilive sey Jesus die and e wake-up; na so too wi bilive sey, doz wey bi Christian before dem die, God go raiz dem up. 15Bikos wetin wi dey tish una naw, na wetin Christ tish sey: Wi wey dey alive wen Jesus go kom, nor go follow am go kon leave doz wey don die bikos, all of us go-go with am. 16God big angel go shaut dey kommand as Christ dey kom down from heaven; di angel vois go dey loud with God trumpet and doz wey bi Christian before dem die, go first go up. 17God go karry wi wey remain for dis world go meet dem for sky, den all of us go-go meet Christ for heaven. 18So make una dey enkourage each oda with all dis word.

Currently Selected:

1 Tesalonians 4: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in