1 Samuel 9
9
Samuel Meet Saul
1E get one man from Benjamin tribe, en name na Kish and en papa na Abiel wey Zeror born and na Bekorat wey en papa na Afia from Benjamin tribe, born Zeror. Dem know Kish well-well for evriwhere. 2E get one pikin, en name na Saul and e fine well-well. E nor get anybody for Israel wey fine rish am and e tall pass evribody for Israel.
3One day, Saul papa donkey kon waka lost, so Kish kon tell Saul, “Make yu take one savant follow body, den make una go find di donkey.” 4So Saul cross Efraim hill kountries kon pass thru Shalisha land, but dem nor si di donkey.
5Wen dem rish Zuf land, Saul kon tell en savant wey dey with am sey, “Make wi dey go back before my papa go stop to worry for di donkey kon dey worry for us.”
6But di savant ansa, “Si, one God savant dey dis town wey evribody dey respet. Evritin wey e tok really dey happen. So make wi go der, may bi e fit tell us wetin wi go do.”
7So Saul ansa, “Okay! Make wi go der. But wetin wi go give di man since wi don finish all di food for awa bag? Wi nor get any gift wey wi go give God savant.” Den e ask en savant, “Na wetin wi still get?”
8Di savant ansa, “Si, I still get small money for my hand. Wi go gi-am to God savant and e go tell us wetin wi go do.” 9(For dat time for Israel, if anybody won go hear from God, e go sey, “Kom make wi go si di pesin wey dey si vishon.” Bikos dat time, dem dey koll profet, “Pesin wey dey si vishon.”)
10Saul tell en savant, “Yu wise well-well! Kom make wi dey go.” So dem kon go di town where God savant dey.
11As dem dey waka enter di town, dem kon meet some girls wey go draw wota dey kom. So dem ask dem, “Di man wey dey si vishon, na here e dey stay?”
12Di girls ansa, “Yes! Make una still waka go strait. But una go waka fast, bikos na today e kom di town and di pipol dey do sakrifice for di altar wey dey di hill. 13And wen una enter di town, una fit si am, before e go-go chop for di altar for di hill. Di pipol nor go chop until e kom, bikos e must bless di sakrifice. Wons e don bless am, doz wey dem invite go bigin chop. Naw make una dey go, bikos na naw una go fit si am.”
14So dem kon waka enter di town. As dem dey waka go di town centre, Samuel dey waka kom dia way and e dey go di altar for di hill.
15Naw, di day before Saul kom, God don tell Samuel: 16“For dis time tumoro, I go send one yong man kom meet yu from Benjamin tribe. Yu go anoint am kon make am king ova my pipol, Israel. E go save dem from Filistia pipol hand. Bikos I don favor my pipol and dia prayers don rish my ear.”
17Wen Samuel si Saul, God kon tell am, “Na di man wey I tell yu bi dis. E go rule my pipol.”
18As Saul dey waka near Samuel for di gate centre, e kon ask Samuel, “Abeg tell mi where di man wey dey si vishon dey stay.”
19Samuel ansa Saul, “Na mi dey si tumoro. Waka for my front go di altar for hill. Today yu go follow mi chop, den yu go-go house tumoro. I go tell yu evritin wey yu dey tink. 20Make yu nor worry about di donkey dem wey lost three days ago, bikos dem don si dem. But na who Israel pipol dey look for? Na yu and evribody for yor papa house?”
21Saul ansa, “Na Benjamin tribe wey small pass for Israel, I from kom and na my family small pass for Benjamin tribe, wetin kon make yu dey tok to mi like dis?”
22Den Samuel take Saul and en savant enter room kon show dem where dem go sleep. Di place betta pass di ones wey dem give doz wey dem invite. Na like thirty men kom di sakrifice. 23Samuel kon tell di pesin wey dey kook sey, “Give mi di food wey I sey make yu keep for mi.”
24So di pesin take di meat leg kon go put am for Saul front. Samuel kon sey, “Di food wey dem keep, na-im dey yor front naw o-o. Chop, bikos na yu dem keep am for since wen I sey, ‘Make una invite pipol kom.’ ” So Saul kon follow Samuel chop.
25Before dem kom down from di altar for di hill kon enter di town, Samuel follow Saul tok on-top di house. 26As dem wake-up for morning, Samuel koll Saul on-top di house kon sey, “Make yu get up dey go house.” So Saul get up and di two of dem kon go outside. 27As dem dey waka kom di town, Samuel kon tell Saul, “Tell yor savant make e waka dey go for front.” So Saul kon tell en savant. Den Samuel sey, “Yu go stay here small, so dat I go-go do wetin God sey make I do.”
Currently Selected:
1 Samuel 9: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: