YouVersion Logo
Search Icon

1 Samuel 8

8
Israel Pipol Ask For King
1Wen Samuel don old, e kon sey make en sons dey judge Israel pipol. 2En first boy name na Joel and di sekond one na Abijah. Dem dey judge Israel pipol for Beersheba. 3But en boys nor follow wetin e tish dem, instead dem dey take bribe and nor dey judge well. 4So all di leaders for Israel gada go meet Samuel for Rama 5kon tell am, “Si, yu don old and yor shidren nor dey do as yu dey do. So make yu choose king wey go lead us, just as all di oda nashons get.”
6But Samuel nor like wetin dem ask for, bikos dem sey, “Give us king wey go lead us.” So Samuel kon pray to God. 7God tell Samuel, “Make yu do evritin wey di pipol ask yu, bikos nor bi yu dem rijet, but na mi dem rijet as dia king. 8Since I take dem komot Egypt kon rish today, na so dem dey rijet mi. Dem rijet mi kon dey serve difren gods. Na di same tin dem dey do to yu naw. 9So naw, make yu do as I tok. But make yu warn dem well-well kon make dem know evritin about how di king go rule dem.”
10So Samuel tell di pipol wey dey ask for king evritin wey God don tok. 11E sey, “E get di way di king go take rule una; e go turn una shidren to sojas; some of dem go bi savant for en shariot and odas go dey run follow di horse.
12“Na only en go choose leaders wey go dey look ova tazon and doz wey go dey look ova fifty, plus doz wey go dey klear en field kon harvest wetin e plant and dem go dey make en war materials for am. 13Una dotas go make pomade, kook and bake for di king. 14E go take una best field and vineyard kon give dem to en own savants. 15One part out of evry ten seed and food wey una harvest, e go kollect am go give en ofisas and savants. 16Una man and woman savant, plus una best animals, di king go take and use dem for ensef. 17E go take one out of evry ten animals wey una get and unasef go bi en savants. 18For dat day, una go kry, bikos of una king wey una take una hand choose, but God nor go ansa una.”
19But di pipol still sey dem wont king. Dem nor gri listin to di warnin wey Samuel dey give dem. 20Dem dey sey, “Wi won bi like oda nashons. Awa king go judge and lead us and e go fight awa fight.”
21So Samuel listin to all wetin di pipol dey tok kon go tell God. 22God tell Samuel, “Go do as dem tok and make yu give dem king wey go rule dem.”
Den Samuel tell di men for Israel, “Make all of una dey go back to una house.”

Currently Selected:

1 Samuel 8: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in