1 Samuel 31
31
Saul Die
1Naw, Filistia sojas dey fight Israel sojas. Di men for Israel run from Filistia sojas and many of dem die for Mount Gilboa. 2Filistia sojas kon katch and kill Saul three sons wey bi Jonatan, Abinadab and Malki-Shua. 3Saul ensef even dey where di war for strong pass and dem kon shot am with arrow and di wound bad well-well. 4So, Saul kon tell en savant wey dey karry en swod sey, “Draw yor swod make yu stab mi, so dat Filistia sojas wey dem nor sekonsaiz, nor go kill mi.” But di savant nor gri stab am, bikos e dey fear. So Saul take di swod kon kill ensef. 5Wen di savant si sey Saul don die, en too kon take en own swod take kill ensef. 6So Saul, en three sons, en savant and all en men kon die dat day. 7Wen Israel men wey dey di valley and di oda side for Jordan River si sey all Israel men don die and Saul and en shidren don die too, dem kon run komot di town. So Filistia sojas kom take-ova di town.
Saul Body Inside Juju House
8Di next day, as Filistia sojas dey kollect tins from di dead body dem, dem kon si sey Saul and en three sons don die for Mount Gilboa. 9Dem kut Saul head komot kon take en tins. Dem kon send pesin make e go tell evribody for dia juju temple and among dia pipol sey Saul and en shidren don die. 10Dem put Saul swod for Ashtoret temple kon hang en body for Bet-Shan wey bi di town wall. 11Wen Jabesh for Gilead pipol hear wetin Filistia pipol do with Saul body, 12all dia sojas kon travel for nite go der. Dem karry Saul and en sons dead body from di town wall kon go back to Jabesh where dem for beri dem. 13Dem take di bones kon beri dem under di tamarisk tree for Jabesh; den dem kon fast for seven days.
Currently Selected:
1 Samuel 31: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: