1 Samuel 26
26
David Sorry For Saul Again
1Zif pipol kom meet Saul for Gibeah sey, “David hide for Hakilah hill wey dey near Jeshimon.”
2So Saul take 3,000 strong sojas wey e selet from Israel kon go find David for Zif desert. 3Saul kamp for di road wey dey near Hakilah hill near Jeshimon, but David dey inside di desert. Wen David know sey Saul dey di desert dey find am, 4e kon send pipol go spy if na true.
5So David kon go di place where Saul kamp put. E si where Saul, Ner pikin Abner and en sojas sleep put. Saul sleep inside di kamp, while en sojas kon sleep round am.
6David tell Ahimelek wey kom from Hit and Abishai; Joab broda wey kom from Zeruaya sey, “Who go follow mi go meet Saul for en kamp?”
Abishai kon ansa, “I go follow yu go.”
7So David and Abishai kon rish der dat nite and dem si sey Saul dey sleep inside di kamp and e pin en spear for groun near en head. Abner and di sojas sleep around am.
8Abishai kon tell David, “Today, God don put yor enemy for yor hand. So make yu let mi shuk en head join groun. I nor nid to do am two times!”
9But David ansa, “Nor kill-am! Na who go happy sey e kill di pesin wey God ensef choose?” 10David still sey, “As God dey alive, na God go kill-am by ensef. One day e go sleep nor wake-up or dem go kill-am for war. 11God forbid sey I kill di pesin wey E choose with en hand.” David kon tell Abishai, “Take en spear and en wota pot make wi komot from here!”
12So David take di spear and di wota pot wey dey near Saul head and dem kon komot der. Nobody si dem or know sey dem kom or wake-up. All of dem don sleep go, bikos God don make betta sleep katch dem.
13Den David cross go di oda side kon stand for far on-top di hill and betta gap dey between en and Saul. 14E shaut give Abner wey bi Ner pikin, “Abner! Yu nor won ansa?”
Abner kon ansa, “Who bi yu wey dey shaut won wake di king?”
15David kon tell Abner, “I tink sey yu bi man? Afta all, who rish yu for di whole Israel land? Wetin kon make yu nor fit guide yor king? One soja almost won kill yor oga di king. 16Yu don fail for yor work. As long as God dey alive, una wey nor fit protet una oga wey God choose as king, dead body betta pass una. Naw make yu find di king spear and wota pot wey dey near en head!”
17Wen Saul know sey na David, e kon sey, “David my pikin, na yor vois bi dat?”
David ansa, “Yes! My oga di king, na my vois.” 18David still sey, “Wetin make my oga di king dey porshu en savant? Wetin I do? Wish bad tin I do? 19So naw, make my oga di king listin to wetin en savant won tok. If na God make yu hate mi; if I offa ofrin to am, E go shange en mind, but if na human being make yu hate mi like dis, God curse go fall for dia head! Bikos dem don porshu mi komot from God land wen dem sey, ‘Make yu go. Go serve anoda god!’ 20Naw my king, nor let dem kill mi for land wey nor bi God own, bikos sey yu dey look for ant like mi, just as pesin dey look for animal for bush.”
21Saul kon ansa, “David my pikin, I don sin! Make yu kom back. I nor go kill yu, bikos yu don save mi today. I bi like fool today and I don make big mistake.”
22David ansa, “Di king spear dey here.” Make one of di savant cross kom take am. 23“God dey reward doz wey dey honest and raitious. Even doh today God put yu for my hand, I nor go ever kill di pesin wey God use en own hand choose. 24Just as I save yor life today, make God save mi from evry trobol and wahala!”
25So Saul ansa David, “My pikin! Make God bless yu. Yu go dey prosper for evritin wey yu do.”
So David go en own way and Saul kon go back.
Currently Selected:
1 Samuel 26: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: