1 Samuel 21
21
David Go Nob
1David go meet Ahimelek wey bi Nob priest. Ahimelek dey fear wen e meet David, so e kon tell am, “Wetin make only yu dey waka without bodyguard?”
2David kon ansa, “Di king sey make I do sometin and e sey, ‘Nor let anybody know why I dey send yu or tell yu dis tins.’ I don tell my sojas make dem wait for one place. 3So naw wetin yu get? Make yu give mi five bread or anytin wey yu si.”
4Di priest ansa David, “I nor get ordinary bread, na only di holy bread dey and di sojas go fit chop am if dem nor sleep with woman.”
5David tell di priest, “True-true, dem nor dey sleep with wimen wen wi dey go war. Dia swods sef dey holy, even doh na ordinary journey wi dey go. So today, dem even dey holy well-well!” 6So di priest give David di holy bread, bikos no oda bread dey der. Dem take am from God present, so dat dem go put hot ones for der.
7One of Saul savant dey der dat day, bikos e nid to do some tins wey God tell am. En name na Doeg wey kom from Edom and na en dey kare for Saul animals.
8David ask Ahimelek, “Yu nor get any spear or swod for here? I don forget my own, bikos I dey rush kom here.”
David Go Gat
9Di priest ansa, “Goliat, Filistia pipol wey yu kill for Ela Valley, na only en swod wey dem wrap with klot put for di efod back, dey here. If yu wont am, make only yu go take am. Anytin wey pass dat one, nor dey here.”
David kon sey, “Nor-tin good rish dat one! Make yu give mi!”
10So dat day, David kon run from Saul go meet King Akish for Gat. 11King Akish savant kon ask di king, “Nor bi David bi dis, David wey bi king for en kountry? Nor bi en pipol dey sing sey,
“ ‘Saul kill 1,000,
but David kill tazon plus tazon.’ ”
12David tink wetin dem tok for en mind kon dey fear King Akish for Gat. 13So wen David dey with dem, e bihave like sey e dey mad. Since e dey under dia pawa, e dey do like mad pesin kon dey rite for dia town gate, while spit go dey rush komot en mout.
14Akish kon tell en savant, “Si dis mad man! Wetin make yu bring am kom meet mi? 15Di mumu dem wey I get nor plenty rish? Why yu bring dis kraze man kom my front? Yu wont make dis mad man enter my house?”
Currently Selected:
1 Samuel 21: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: