1 Samuel 18
18
Saul Dey Fear David
1Wen David don tok to Saul finish, en and Jonatan kon turn tait friend. Jonatan like David as e like ensef. 2Dat day, Saul take David and e nor let am go house go meet en papa. 3Jonatan kon make kovenant with David, bikos e love am as e love en own life. 4Jonatan remove di gown wey e wear kon gi-am to David, plus en gear, en swod, en bow and even en belt.
5Anytin wey Saul send David go do, e dey do am well with sense. So Saul kon make am oga ova di sojas. Dis tin kon make belle sweet di sojas and even Saul savants.
6Wen dem kom back afta David don kill Filistia pipol, di wimen for di town kom out kon dey sing, dey dance go meet King Saul. Dem dey happy as dem dey play dia instruments dey kom. 7Di wimen wey dey play di music kon dey sing sey,
“Saul kill 1,000,
but David don kill tazon times tazon pipol.”
8Dis tin kon make Saul dey vex. E nor like di word wey di wimen dey tok and e kon tink for en mind sey, “Dem dey sey David don kill tazon times tazon pipol, but mi, only 1,000. Wetin e nor get escept di kingdom?” 9So Saul kon dey look David one kind from dat day go.
10Di next day, one wiked spirit from God enter Saul and e kon dey tok for inside di house. So David dey play di jita for am. E get one spear wey dey Saul hand, 11den Saul trow di spear, bikos e tink for en mind sey, “I go nail David for di wall!” But David dodge am two difren times.
12So Saul kon dey fear David, bikos God Spirit wey don komot from am, dey with David. 13Saul sey make David komot en present, but e still make am di sojas oga. David dey karry di sojas go war and bring dem back. 14David dey use sense take do evritin wey Saul send am, bikos God dey with am. 15Wen Saul si as David wise rish, e kon dey fear am. 16But evribody for Israel and Judah like David, bikos na en dey take dem go war and bring dem back.
17Den Saul tell David, “Na my senior girl bi dis, en name na Merab. I wont make yu marry am. I just wont make yu dey strong for mi and fight God war.” Bikos Saul tink sey, “No nid for mi to kill-am, make Filistia pipol kill-am!”
18David kon tell Saul, “Who I bi? Who bi my family or my papa tribe for Israel wen I go kom bi di king in-law?” 19Wen di time rish wen dem won give Saul pikin, Merab to David, dem kon give di girl to Adriel wey kom from Meholah.
20Mikal wey bi Saul pikin, like David. Wen dem tell Saul wetin dey happen, en belle kon sweet am. 21Saul kon sey, “I go give Mikal to David, so dat Mikal go bi trap for am and Filistia pipol go kill-am.” So Saul tell David, “Today, na di sekond time for yu to bi my in-law.”
22Den Saul tell en savant, “Make yu use brain tell David for korna sey, ‘Di King dey happy with yu and all en savants like yu. So make yu marry di king pikin.’ ”
23So Saul savant go tell David wetin di king tell am make e do. David ansa, “Na betta honor to marry di king pikin. Di honor too mush for pesin like mi wey nor bi anytin!”
24Wen Saul savants tell am wetin David tok, 25Saul kon sey, “Dis na wetin una go tell David: ‘Di king nor wont money for di girl; di only tin wey e wont na hundred Filistia pipol skin, so dat e go pay en enemies back for di tins wey dem don kause.’ ” (Naw, Saul bilive sey David nor go survive dis one.)
26So en savants tell David and David gri sey e go marry di king pikin. Naw, di time wey di king give David neva pass, 27den David with en men go fight kon kill two hundred Filistia pipol. David take dia skin go give Saul, so dat e go fit marry di king pikin. So Saul give en pikin Mikal to David make e marry.
28Wen Saul know sey God dey with David and en pikin Mikal love David well-well, 29e kon dey fear David more-more and from dat day go, Saul kon hate David more-more.
30Anytin time Filistia oga karry dia sojas kon fight, David dey win dem pass any oda Saul savants. Bikos of dis, pipol kon know David well-well.
Currently Selected:
1 Samuel 18: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee