1 Samuel 12
12
Samuel Message
1Samuel tell Israel pipol, “I don do evritin where una ask for. I don give una king. 2Naw, make una listin! Na dis king go lead una. I don old and get white hair full body, but my sons dey with una. I don dey lead una since wen I yong kon rish today. 3Naw, as I dey here so, anybody fit tok bad about mi before God and di king wey E choose? I don use force take anybody animal? I don do anybody wrong? I don opress anybody? I don take bribe from anybody hand wey make mi nor tok trut? Make una tell mi and I go ansa una!”
4Di pipol ansa, “Yu neva do us wrong or opress us. Yu neva take anytin from anybody hand.”
5Samuel kon tell dem, “God and di king wey E choose na witness sey una neva akuiz mi for any bad tin.”
Di pipol ansa, “Yes! Dem bi witness!”
6Samuel tell di pipol, “Na God choose Moses and Aaron and na en take una grand-grand papa komot from Egypt. 7Naw, make una stand for God present, so dat I go remind una about all di good-good tins wey God don do for una and una grand-grand papa.
8“Wen Jakob enter Egypt, una grand-grand papa dem kon kry to God. God send Moses and Aaron and dem lead dem komot from Egypt kon stay for here.
9“But dem forget di Oga wey bi dia God, so E give dem to Sisera wey bi oga for Hazor sojas, den to Filistia pipol; Moab pipol king and dem kon fight and opress Israel pipol. 10Den Israel pipol kry to God sey, ‘Wi know sey wi don sin, bikos wi don forget Yu and wi dey serve juju and Ashtoret image. Abeg! Make Yu kom save us from awa enemies hand and wi go serve Yu forever.’ 11So, God send Jerub-Baal, Barak, Jeftah and Samuel and E kon save una from una enemies.
12“Wen una si sey King Nahash for Ammon dey kom fight una, una sey, ‘No! Wi wont king’, even doh na di Oga una God bi una king! 13Naw make una look! Na di king wey una choose bi dis; di king wey una ask for. Si, God don give una king. 14If una fear God kon serve and obey am and una nor go against wetin E tok and if una and di king wey dey rule una follow di Oga una God, den evritin go dey well with una. 15But if una nor obey God kon go against wetin E tok, God hand go dey against both una and una king.
16“So, make una stand for where una dey kon wosh di great tins wey God go do and una go si am with una eye. 17Abi nor bi di time to harvest grain bi dis? I go koll God, so dat E go send betta tonda and rain kom. Make una open una eye kon si how una don sin rish, wen una ask God for king wey go lead una.”
18So Samuel koll God and God kon make tonda and rain fall thru-out dat day. All di pipol kon dey fear God and Samuel.
19Dem kon tell Samuel, “Make yu help us pray to God, so dat all of us nor go die, bikos wi don add join awa sins, wen wi ask for king.”
20Den Samuel tell di pipol, “Make una nor fear. True-true, una don sin. But make una nor turn from God. Make una serve God with all una heart. 21Make una nor bigin follow tins wey nor mean anytin, tins wey una nor go gain from or tins wey nor fit save una. 22God nor go leave en pipol, bikos E don make promise with una grand-grand papa. God happy to make una en own pipol. 23As for mi, God forbid sey I nor go dey pray for una again, bikos dat na sin. I go tell una di tin wey dey good and wey dey make belle sweet God. 24Make una dey fear and serve God with all una heart. Make una si all di wonderful tins wey E don do for una! 25But if una kontinue to dey do bad tins, God go distroy both una and una king.”
Currently Selected:
1 Samuel 12: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: