1 Kings 7
7
Solomon Palis
1Solomon still build palis for ensef and na thirteen years e take build am. 2E koll am “Di Palis for di Lebanon Forest.” E long rish 150 fit, wide rish 75 fit and e high rish 45 fit. E get four rows wey dem make with cedar pilas and cedar wood dey on-top di pilas too. 3Na cedar wood dem still use take make di roof on-top di wood wey support di pilas; dem bi forty-five wood and na fifteen dey each row. 4For each side for di wall, na three-three windows dey each row. 5Evriwhere wey dem dey pass enter, get four side and dem arrange dem into three set.
6Di Passage Hall long and wide rish 75 and 45 fit. E get korridor and pila and roof dey di korridor front.
7Solomon still make one throne room kon koll am “Judgement Hall” and na der e for dey judge kase. Dem make am with cedar wood from groun go rish di roof. 8Na so too dem take make di palis where Solomon dey stay. E still build one palis like en own kon gi-am to Fero dota wey e marry.
9Na di best stones dem take build and karve all dis tins kon kut dem with saw; from di roof foundashon and from di outside go rish di great kourtyard. 10Na betta-betta stones dem take make di foundashon. Some long rish twelf and odas, na fifteen fit. 11On-top di foundashon, di best stones wey dem karve for di rite side, na-im dem use with di cedar wood. 12Around di great kourtyard, na three row of betta stones and one row of cedar wood dey der like di kourt for inside God Temple and di palis hall.
Hiram And King Solomon
13King Solomon sey make dem go koll Hiram kom from Tyre. 14Na one woman from Naftali wey en husband don die, born am and en papa na kraft man wey bin dey work with bronze for Tyre. E get wisdom to take make any kind tin with bronze. E go meet King Solomon kon do all di work wey dem gi-am.
15Hiram make two bronze pila; each pila tall rish 27 fit and wide rish 18 fit. 16E still make bronze top for di pilas and each one high rish seven and half fit. 17Na shain wey dem weave dem take dekorate di top 18and di two rows with di bronze stones. 19Dem design di top like lily leaf and e tall rish 6 fit 20kon put am for one round place wey high pass where dem design with shain. For di main top, na 200 betta stones dey round one pila. 21Hiram put dis two bronze pila for where dem dey pass enter di temple. Di one wey dey di sout-side na, “Jakin”, while di one for nort na, “Boaz.” 22Di pila top bi like lily. So dem kon build di pila finish.
23Hiram still make di big bronze basin wey dem dey koll “Di Sea.” E deep rish seven and half fit kon long and wide rish 15 and 45 fit. 24Di basin korna for outside get two bronze iron and na one block dem take build am with di basin.
25Di basin dey on-top twelf melu. Three face di nort; three face di west, three face di sout and three face di east. Di Sea dey on-top of dem and all of dem face outside. 26Di basin tick rish three inches. En rim bi like cup own wey curve out like lily and di basin fit kontain 12,000 gallon of wota.
27Hiram still make ten bronze stand wey dem fit move. Each stand tall and wide rish 6 fit and dem high rish four and half fit. 28Dem make dem with panel kon set dem with frame, 29den dem draw lion, bulls and di creatures wey get feada for di body. Dem still draw dem put for di frames for up and under di lion and di melu, den dem rite sometin put. 30Each of di four stand get four bronze wheel with bronze axles. Dem put bronze for di four korna wey go support di basin, den rite sometin take dekorate di wood wey support am. 31Di basin get one round frame. Di kart tall rish 18 inches kon deep rish 7 inches. Dem still karve tins round am. 32Di wheel high rish 25 inches and dem dey under di panel, but di axles and di kart na di same. 33Di wheel bi like shariot own and na bronze dem take make dia axles, rim, spokes and hub.
34All di karts get four support for under and dem bi di same with di karts. 35Nine inches band dey round di top for each kart, dem dey support di kart and di panel na di same with di kart. 36Hiram use animals wey get feadas, lion and palm trees, take dekorate di wood wey support am, di panel and anywhere space dey, den e rite full dia body. 37Na so dem take make all di kart. All of dem resemble and dem bi di same size and shape.
38Hiram still make ten basin for each kart. One basin wide rish 6 fit wey go kontain 200 gallon of wota. 39E put five kart for di sout-side for di temple and di oda five dey di nort side, den kon put di tank for di korna wey face sout and west korna. 40Hiram still make shovel, basin and plates.
E finish all di work wey Solomon gi-am for God temple. 41Na wetin Hiram make bi dis:
di two pilas;
di two top for di pilas wey bi like bowl;
di art work wey dey di bowl on-top di two pilas;
42di 400 fine stones wey dem design for di art work for di two pilas; all di art work with dia two lines of fine stones on-top di bowl for di pilas;
43di ten stands wey dey move with di ten basins;
44di big bronze basin wey dem dey koll, “Di Sea” with twelf melu wey dey under am;
45di pots, shovel and bowls.
So, all di tins wey Solomon sey make Hiram make for di temple, na bronze wey dem polish dem take make dem. 46Between Sukkot and Zaretan borda for Jordan, na der di king for make all dis tins. 47Solomon nor weigh all di bronze tins, bikos dem too plenty. So, dem nor know how dem heavy rish.
48Na gold Solomon take design di temple,
di altar,
di tabol wey dem dey put God bread,
49di ten lampstand wey dey for di Most Holy Place wey five face sout and five face nort;
di flowers, lamps and tongs.
50Di cups, lamp tins, bowls, plate for incense and di pans wey dem take dey karry shako;
di Most Holy Place door handle and di doors wey dey outside di temple. Na gold dem take make all dis tins.
51Wen King Solomon don finish di temple work, e kon put all di tins wey David en papa dedikate give God, inside di temple store room: di silva, gold and all di oda tins.
Currently Selected:
1 Kings 7: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee