1 Kings 6
6
Solomon Build Di Temple
1Afta 408 years wen Israel pipol don komot from Egypt, wey bi di fourt year wen Solomon don dey rule Israel, for di sekond mont wey bi Ziv mont, Solomon kon start to build di temple.
2Di temple long rish 90 fit kon wide rish 30 fit and e high rish 45 fit. 3Di passage wey dem take dey enter di temple wide rish 30 fit and na so e long too. E still use 15 fit take long go outside. 4Solomon still use frames make windows for di temple. 5E build some room take join di temple walls for outside. 6Di rooms for outside na three story building and di bottom floor wide rish seven and half fit, di middle floor na 9 fit while di top floor na ten and half fit. E build di room join di temple but dia timba nor enter di wall.
7Dem make di stones wey dem take build di temple, from where dem for kut dem, so no hammer, axe or any oda iron make sound for di main site. 8Where dem dey pass enter di down floor dey di sout-side for di temple and dem put step to take klimb go di sekond and di third floor. 9So Solomon kon build di temple finish. E put ceiling wey dem make with woods and cedar boards. 10E build difren rooms round di temple; dem high rish seven and half fit and e use timba join dem to di temple. 11God tell Solomon, 12“But for dis temple wey yu dey build, If yu obey all my laws and kommand, evritin wey I promise yor papa David, I go do dem for yu. 13I go stay with my pipol Israel and I nor go ever abandon dem.”
14So, Solomon kon build di temple finish. 15From di groun go rish di ceiling for inside, na cedar wood dem take kover dem kon make di floor with pine wood. 16Di room for inside wey dem dey koll, “Most Holy Place” na di temple back dem build am put. E long rish 30 fit and dem use cedar board take divide am from groun go rish di ceiling. 17Di room wey dey front for di “Most Holy Place”, long rish 60 fit. 18Dem dekorate di cedar panels with tins wey den karve and with flowers, den dem use cedar wood kover di inside, so dat dem nor go si di stones wey dey di wall.
19Dem build di inside room for di temple back and dem won put God Kovenant Box for der. 20As di inside room long, na so too e high rish 30 fit and dem kover evriwhere with gold. Dem kover di temple with cedar panels. 21Dem kover di temple for inside with gold kon use gold shain cross and kover where dem dey pass enter. 22Dem kover evriwhere for inside di temple with gold, plus di altar wey dey di “Most Holy Place.”
23Dem make two creatures wey get feadas with olive wood and di creatures dey di, “Most Holy Place.” Each of di creature, tall rish fifteen fit. 24Each of di first creature feada long rish seven and half fit, so di two feada na 15 fit. 25Di sekond creature bi like di first one but for size and shape; 26each of dem tall rish 15 fit. 27Dem put dem for di two side for di “Most Holy Place.” So dia feadas wey dem spread, go tosh each oda for di room middle and di oda two feadas tosh di wall. 28Na gold dem use take make di two creatures.
29Dem use creatures wey dem karve with feadas, palm tree and flower, take dekorate di wall both for inside and outside. 30Dem even use gold take dekorate di floor.
31Na olive wood dem take make doors wey pipol go pass enter and di pila for each door, get five side. 32Di two doors wey dem make with olive wood, dem karve doz creatures with feadas, palm tree and flower put kon kover dem with gold. 33Like dis, dem make door-mot with olive wood for di place wey dem dey pass enter di main hall and dem get four pila for di side. 34Dem still make two doors with pine wood and each door get two side wey dey fold. 35Dem karve creatures with feadas, palm tree and flower take dekorate am kon kover all of dem with gold.
36Dem build one kourt for di temple front kon use cedar wood and stones take make di wall.
37For Ziv mont, for di fourt year wey Solomon don dey rule, naim dem lay di foundashon for God Temple. 38For Bul mont (wey bi di eight mont) for di elevent year, dem komplete di temple just as dem plan sey e go bi. Na seven years Solomon take build di temple finish.
Currently Selected:
1 Kings 6: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: