1 Kings 4
4
Solomon Ofisas
1King Solomon rule evriwhere for Israel land. 2Dis na en ofisas:
Azaraya wey bi priest and na Zadok bi en papa.
3Elihoref and Ahijah wey bi Shisha shidren na dem bi seketry for di kourt.
Jehoshafat wey bi Ahilud pikin, na en dey keep rekord.
4Na Jehoiada pikin, Benaya bi di sojas oga.
Na Zadok and Abiatar bi priest.
5Na Natan pikin, Zabud bi shief to di difren govnor.
6Ahishar dey kare for di palis savants,
while Adoniram wey Abda born, dey kare for doz wey dey do hard work.
7Solomon put twelf men as govnor for Israel. Na dem dey provide food for di king, en family and di difren aria. Each of di twelf men dey handle each mont for di year. 8Dis na di ofisas and di district wey dem dey kare for:
Ben Hur dey kare for Efraim hill kountries;
9Ben-Deka dey kare for Makas, Shaalbim, Bet-Shemesh, Elon and Bet-Hanan town.
10Ben-Hesed dey kare for Arubbot, Soko and all di aria for Hefa.
11Ben-Abinadab wey marry Solomon dota Tafat, dey kare for all di aria for Dor.
12Baana wey Ahilud born, dey kare for Taanak, Megiddo and all di aria for Bet-Shean near Zaretan town, for di sout-side for Jezrel town go rish Abel-Meholah and Jokmeam town.
13Ben-Geber dey kare for Ramot town for Ramot Gilead and all di village for Ramot wey Jair town get and na Manasseh grand-grand pikin e bi. E still dey kare for all di aria for Argob for Bashan wey bi sixty big towns wey dem fence round and e get bronze bars.
14Ahinadab wey bi Iddo pikin dey kare for Mahanaim aria.
15Ahimaaz wey still marry Basemat wey bi King Solomon dota, dey kare for Naftali aria.
16Baana wey bi Hushai pikin dey kare for Asher aria and Bealot town.
17Jehoshafat wey bi Paruah pikin, dey kare for Issakar aria.
18Ela pikin wey bi Shimei dey kare for Benjamin aria.
19Gibeah wey Uri born, naim dey kare for Gilead wey King Sihon from Amor and King Og for Bashan bin dey rule. Apart from dis twelf, e still get one govnor wey dey rule di whole land.
Solomon Reign
20Israel and Judah pipol plenty like san-san for wotaside; dem get enough food to chop and drink and dem dey happy. 21Na Solomon dey kontrol all di nashons from Eufrates River go rish Filistia and Egypt borda. Dem dey under am dey pay tax gi-am till e die.
22Di tins wey Solomon nid evriday, na 150 bag of fine flower and three hundred bag of food, 23den 10 big melu, 20,000 fat melu and 100 sheep with deer, gazelle and bird wey dem feed well. 24Solomon rule di west and evriwhere for Eufrates River. From Tifsah for Eufrates side go rish di west for Gaza town. All Eufrates king dey under am and e dey make peace with all di kountries wey near am. 25Judah and Israel pipol get peace thru-out di time wey Solomon dey rule and all di family get dia own grapevines and fig trees.
26Solomon get 4,000 house for en shariot and 12,000 horse.
27Na di twelf govnor dey bring di food wey Solomon and all di pipol for di palis go chop. Each one, for each mont. 28Each govnor dey bring en own barley and straw for di shariot and animals wey dey work kom di propa place wey dem suppose take am go.
29God give Solomon betta wisdom, sense and en undastandin big well-well. 30Solomon get sense pass di wise men for east and for Egypt. 31Na-im wise pass among all men. E wise pass Etan wey kom from Ezra and Heman, Kalkol, Darda wey bi Mahol shidren. So pipol kon dey tok about Solomon wisdom for all di kountries wey dey near Israel 32E rite 3,000 parabol and di songs wey e rite, pass 1,000. 33E rite about trees and plants, like di cedar wey dey Lebanon and di plant wey dey grow for wall. E still rite about animals, birds, animals wey dey creep and fish. 34All di kings for di world hear about en wisdom, so dem kon send pipol go listin to am.
Currently Selected:
1 Kings 4: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee