1 Korintians Introdushon
Introdushon
Paul karry di news about Jesus Christ, di Messiah, go Masidonia (Greece) but leta, e get to run go Akaia wey dey sout for Greece so dat dem nor go kill-am. From der, e visit Korint town and many pipol kon bilive en message, so e stay der for one and half year kon tish di pipol. Afta Paul komot Korint, di pipol kon rite one leta (wey nobody know where e dey naw) to ask am some kweshons. Korint pipol dey follow Greek pipol bilive wey sey fisical tins or body dey bad, so dem won try free humanbin spirit from en body. Dis tin kon affect di way dem dey si tins like marriage, to go party where dem dey chop juju food and how Jesus take raiz-up afta e die. Dis book na mainly to ansa di kweshons wey di pipol get.
Currently Selected:
1 Korintians Introdushon: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: