YouVersion Logo
Search Icon

1 Korintians 8

8
Juju Food
1For di leta wey una rite, una ask mi about juju food. And all of us know sometin koncerning dis matter. But if wetin wi know, dey make us dey proud, den bikos of love, wi suppose help one anoda. 2Di man wey tink sey e know sometin, neva still know as e suppose know. 3But God know di pesin wey love am.
4So, even if pipol dey offa food give juju, all of us know sey di juju dem nor get life, bikos na only one God dey. 5Dem dey koll many tins for heaven and eart, “gods and mastas,” but non of dem really bi god or masta. 6But wi (wey bi Christian), na only one God wi get and naim bi awa Papa. Na-im kreate evritin and wi dey live for am. Na Jesus Christ bi awa only Oga God. Na-im make evritin and na thru am wi get life.
7Nor bi evribody know dis tins. Some pipol don grow with di bilive sey juju dey alive. So wen dem dey chop meat wey dem give juju, dem go dey fear. 8But wi know sey food nor fit bring us klose to God. Wi nor go luz anytin if wi nor chop or sey wi gain anytin if wi chop. 9But make una dey kareful, so dat weak pesin among una nor go fall bikos una don dey free to chop anytin. 10Bikos if weak pesin si yu wey know di word dey chop juju food, e go fit join yu chop di food wey dem sakrifice give juju. 11Den wetin yu know don distroy pesin wey Christ die for. 12If yu sin against yor brodas or sistas wey nor get strong heart and faith, yu don sin against Christ. 13So, if food wey I dey chop go wound pesin wey dey follow Christ, I nor go ever chop meat again, so dat my brodas and sistas nor go sin.

Currently Selected:

1 Korintians 8: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in