1 Korintians 3
3
Di Church Divide
1My brodas and sistas, wen I dey with una before, una dey bihave like pipol for dis world. Na dis make mi nor fit tok to una as pipol wey get God Spirit. Dat time, una faith for Christ bi like small pikin own. 2So I dey feed una with milk like small pikin and as e bi naw, una neva still fit chop strong food, 3bikos una neva get di Spirit since jealousy and kworel still dey among una. Dis mean sey una neva get di Spirit and una still dey live like pipol wey dey di world. 4Some of una dey sey, “Na Paul I dey follow,” odas sey, “Na Apollos bi awa leader.” Na pipol wey nor know God dey do like dat!
5Mi and Apollos na God savant and E use us take prish to una make una for fit bilive, so mi and am dey do di work wey God sey make wi do. 6I dey plant di seed and Apollos dey wota dem, but na God dey make di seed grow. 7Pesin wey plant and di one wey wota, nor mean anytin, bikos na God dey make di seed grow. 8Di pesin wey plant di seed and di one wey wota am, na di same work dem dey do, but each pesin go get en pay from God akordin to en work. 9All of us na ko-workers for God and na una bi God farm and en buildings. 10Na God grace make mi sabi build well-well. I lay foundashon wey anoda pesin build put. But make wi take kare as wi dey build, 11bikos God don choose Jesus Christ as di One and only foundashon and dem nor go fit lay any oda foundashon. 12So if anybody use gold, silva, fine stones, wood, or difren grass take build on-top dis foundashon, 13make e know sey, God go espose en work, bikos E go test am with fire for Judgement Day. Di fire go test di work wey evribody dey do. 14God go reward us if di fire nor burn wetin wi build. 15But if di fire distroy am, wi nor go get anytin. But wi go dey save like pesin wey dem drag komot from inside fire.
16Una nor know sey una bi God Temple and en Spirit dey inside una? 17So If anybody distroy God Temple, God go distroy dat pesin too, bikos God Temple dey holy and na una bi dat temple.
18Make una nor let anybody deceive una. If anybody tink sey e get sense for dis life, make e turn to fool, so dat e go really get sense. 19Dis world wisdom, na foolishness for God present. Bikos God word sey, “God dey ponish pipol wey tink sey dem wise.” 20God know sey na yeye tins wise pipol dey tink, 21so, make wi stop to dey boast about wetin pesin do. Bikos both 22Paul, Apollos, Pita, di world, life or deat; tins wey dey naw or tins wey go dey tumoro, all of dem na una own. 23So una bi Christ own, just as Christ bi God own.
Currently Selected:
1 Korintians 3: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: