1 Korintians 16
16
Help For Jerusalem Christians
1Wen una kollect money from God pipol, I wont make una do as I tell di pipol wey dey di church for Galatia sey make dem do. 2Evry Sunday, make each pesin dey keep some money for korna from di one wey e don work, as God help am rish, so dat una nor go nid to kollect money wen I kom. 3Wen I kom, I go send pipol wey una choose kon give dem leta as dem dey karry una gifts go Jerusalem. 4But if una sey make I go too, den, dem go follow mi go.
5And afta I don finish for Masidonia, I hope to kom si 6and stay with una for sometaim. May bi I fit stay till dry sizin finish, so dat una go fit help mi for anywhere wey I won go. 7If God go let mi, I nor go one branch si una for small time naw, bikos I go like kom leta, so dat I go fit spend more time with una. 8But I go stay for Efesus until Pentekost go finish, 9bikos plenty work dey wait for mi for der, even doh di shalenge strong well-well.
10Wen Timoti kom, make una nor make am fear at-all, bikos na God work wey I dey do, naim e dey do too. 11So make evribody respet am, den make una send am kom meet mi with peace, bikos I dey espect am with di oda brodas.
12I don try well-well make Apollos for fit follow oda bilivers kom visit una, e nor won kom naw, but e go kom leta.
13Make una shine una eye and dey strong for una faith and stand with boldness. 14For evritin wey una dey do, make una dey show love.
15Una know sey na Stefanas and en family first bilive God for Akaia. Dem don do evritin wey dem fit do for God pipol. My friends, I wont make una 16dey obey dis leaders and doz wey dey follow una do God work. 17I dey happy sey Stefanas, Fortunatus and Akaikus don kom; dem kom ripresent una 18and dem don let belle sweet mi, just as dem make belle sweet una. E good make wi dey tok about pipol like dem.
19Pipol for di church wey dey Asia aria dey greet una; Akwila and Priscilla with di church pipol wey dey meet for dia house, dey greet una too. 20All di brodas sey make I greet una.
21Na mi Paul, rite dis leta with my own hand.
22Anybody wey nor love Christ, curse dey en head!
23Make awa Oga God Jesus Christ grace dey with una.
24Make my love for Jesus Christ, dey with all of una too.
Currently Selected:
1 Korintians 16: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: