1 Korintians 14
14
Profesy And Difren Language
1Na love suppose guide una. So make una dey fight to get di gift wey di Holy Spirit dey give, especially di gift to profesai. 2Bikos if una dey tok with difren-difren language wey odas nor undastand, God go undastand wetin una dey tok, aldo know oda pesin go know wetin e mean. Tins wey una go dey tok about, na only di Spirit go fit undastand dem. 3But wen una profesai, pipol go undastand una and odas go help una. Dem go get konfort kon dey okay. 4Pesin wey dey tok with difren language, dey help ensef. But di one wey dey profesai, dey help di church. 5I for like make all of una dey tok with difren language, but I wont make una dey profesai. Bikos profesy go do una more good, dan sey una dey tok with difren language wey pipol nor fit undastand, unless somebody esplain di meaning give di pipol for di church.
6My brodas and sistas, wetin una go gain if wen I kom, I dey tok with difren language wey una nor undastand and I nor esplain am? How I go fit help una den, unless I tell una wetin God tell mi or make una know wetin dem profesai and tish? 7If all music instrument get di same sound, how una go take know di one wey bi trumpet or harp? 8If trumpet make sound wey pipol nor undastand, who go dey ready to go fight war? 9Na so e bi wen una dey tok with difren-difren language wey pipol nor undastand. If nobody fit undastand wetin una dey tok about, dat mean sey na breeze una dey follow tok. 10Dis world get difren language and all of dem dey good. 11But if odas nor undastand wetin una tok, den dem go bi like strenjas to una. 12Na so e bi with una too. If una really wont di gift wey di Spirit dey give, make una choose di one wey di church go gain from.
13So wen wi tok with difren-difren language wey odas nor undastand, make wi pray make God give us di pawa to esplain wetin e mean. 14For ezample, if I pray with language wey nobody undastand, my spirit dey pray, but my mind nor undastand di tins wey I dey pray for. 15So wetin I go do? Bikos e get time wey I go pray with my spirit and time wey I suppose pray with my mind. Sometaim, I suppose sing with my spirit and oda time, I go sing with my mind. 16If some strenjas dey for where una for dey woship God for spirit and dem nor undastand una, how dem go take know wen to sey, “Amen”? 17Una fit really dey woship God well-well, but nobody go gain from am, bikos dem nor undastand wetin una dey tok. 18I tank God sey I dey tok with difren-difren language pass all of una. 19But wen I dey church, e betta make I speak five betta words to tish odas, dan to speak 10,000 words wey pipol nor undastand.
20My brodas and sistas, make una stop to tink like small shidren. Instead make una dey tink like mature pipol and dey innocent like pikin wey dem just born. 21God word sey: “I go use strenjas wey dey speak wetin odas nor undastand, take tok to my pipol. Dem go tok to dem with strenj language, but my pipol nor go listin to mi.” 22So, language wey odas nor undastand, fit mean sometin to pipol wey nor bilive, but nor bi to pipol wey bilive. 23So if di whole church bigin tok with difren-difren language, den some pipol wey bi unbilivers or doz wey nor undastand kon waka enter di church, dem nor go tink sey all of una don dey kraze? 24But if evribody dey profesai and unbilivers or pipol wi nor undastand enter di church, dem go know sey dem bi sinnas and dem go won turn from dia sin kom meet God, bikos of wetin una dey tok. 25Den God go tell una di sekret wey dey dia heart. Den dem go knee down kon tell God sey, “Wi don really bilive sey yu dey with dis pipol.”
Orda For Church
26My friends, wen una gada to woship, una must do evritin to help one anoda. Na so e suppose bi wen somebody dey tish, sing, profesai, tok with difren-difren language or dey esplain wetin di pesin tok. 27Wen una dey togeda, make e nor pass two or three pipol wey go tok with difren-difren language wey pipol nor undastand. One pesin go tok, before anoda and make pesin dey, wey go esplain give odas wetin di pesin dey tok. 28If nobody dey wey go fit esplain wetin yu dey tok, make yu nor tok at-all for di meetin, but yu fit tok am between yu and God. 29Two or three pesin fit profesai and evry oda pesin must listin well-well. 30And if one among di pipol wey sidan receive message from God, di pesin wey dey tish must stop make di pesin for tok. 31Make di pipol nor tok at wons, so dat all of una go learn sometin and una go dey okay. 32Pesin wey bi profet must dey ready to stop, so dat anoda pesin go tok, bikos profet suppose to fit kontrol en own spirit, 33bikos God wont make dem do evritin well.
Wen God pipol meet for church, 34make wimen nor dey tok. Make dem kwayet dey listin, just as Moses Law tish. 35If dem won know about sometin, dem fit ask dia husband wen dem rish house. Bikos na disgrace for woman to tok for church. 36God message nor start with una and nor bi only una don hear am.
37If una dey tink of unasef as profet or pesin wey di Spirit dey use, den una go know sey I dey rite only di tins wey God kommand mi. 38So make una nor listin to anybody wey nor bilive wetin I dey rite. 39My friends, make una dey try to profesai and make una nor stop anybody wey dey tok with difren-difren language even doh odas nor undastand wetin e dey tok. 40But make una dey do tins as e suppose to bi.
Currently Selected:
1 Korintians 14: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: