1
Romans 8:28
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
And wi know sey evritin dey work for awa good, bikos wi love God and dey do wetin E wont.
Compare
Explore Romans 8:28
2
Romans 8:38-39
But I dey sure sey, weda na deat or life; angels or wiked pawas; tins wey dey naw or di ones wey dey kom; tins wey dey heaven; tins for under dis eart or anytin wey God kreate, non of dem go fit separate us from God love, bikos of Jesus Christ wey bi awa Oga God.
Explore Romans 8:38-39
3
Romans 8:26
Na so too di Holy Spirit dey help us bikos wi dey weak. Bikos wi nor know wetin wi suppose to pray for, di Spirit by ensef dey kry beg God, for di way awa word nor go fit esplain.
Explore Romans 8:26
4
Romans 8:31
Wetin wi go tok about all dis tins? If God dey for awa side, who go fit dey against us?
Explore Romans 8:31
5
Romans 8:1
So, God nor go kondemn pipol wey bilive Jesus Christ.
Explore Romans 8:1
6
Romans 8:6
If wi let sin rule awa mind, wi go die. But if na di Spirit dey rule us, wi go get life and peace.
Explore Romans 8:6
7
Romans 8:37
Inside all dis tins, awa joy don dey full, bikos Jesus love us!
Explore Romans 8:37
8
Romans 8:18
I dey sure sey, wi nor go fit kompare all di sofa wey wi dey sofa naw, with di glory wey God go give us.
Explore Romans 8:18
9
Romans 8:35
Na who go fit separate us from Christ love? Na trobol or opreshon; honga or poverty; wahala or deat; or na bikos klot nor dey to wear?
Explore Romans 8:35
10
Romans 8:27
And God wey dey si evritin inside awa belle, know wetin dey di Spirit mind, bikos di Spirit dey pray for all God pipol, as God wont.
Explore Romans 8:27
11
Romans 8:14
Na doz wey God Spirit dey lead, bi God shidren.
Explore Romans 8:14
12
Romans 8:5
Bikos pipol wey dey live by dia own mind, dey tink of only demsef. But evribody wey di Holy Spirit dey rule, dey tink of tins wey di Spirit wont.
Explore Romans 8:5
13
Romans 8:32
True-true, if E let dem kill en own pikin for awa sins, den E go fit give us evritin wey wi ask from am free of sharge!
Explore Romans 8:32
14
Romans 8:16-17
Na God Spirit make us know sey wi bi God shidren. And if wi bi God shidren, den wi go inherit God propaty. Yes, wi go follow Christ inherit God propaty, bikos if really wi sofa with am, wi go follow am enjoy.
Explore Romans 8:16-17
15
Romans 8:7
Pipol wey dey sin, na God enemy dem bi, bikos dem nor obey en law, since dem nor fit obey am.
Explore Romans 8:7
16
Romans 8:19
Evritin wey God kreate for dis world, dey wait for God to show en shidren to di world.
Explore Romans 8:19
17
Romans 8:22
Wi know sey evritin wey God kreate, dey kry, just like di way woman wey won born dey kry.
Explore Romans 8:22
Home
Bible
Plans
Videos