Afta dem don gada and plan with di eldas, dem kon give di sojas plenty money, kon tell dem sey, “Make una tok sey, ‘Jesus Christ disciples kom tif en body for nite wen wi dey sleep.’ If di govnor hear about dis matter, wi know wetin to tell am and una nor go enter trobol.” So dem take di money kon do as di eldas tell dem. Pipol still dey tok dis story for evriwhere wey Jew pipol dey, kom rish today.