1
Matiu 26:41
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
Open yor eye make yu pray, so dat yu nor go fall inside temptashon. Yor spirit won do am, but yor flesh dey weak.”
Compare
Explore Matiu 26:41
2
Matiu 26:38
Den e tell dem, “My heart heavy and e bi like sey I won die. Make una stay here and make una nor sleep.”
Explore Matiu 26:38
3
Matiu 26:39
E waka go front small kon liedan face groun, den e kon pray, “My Papa, if yu wont, yu go fit remove dis deat from mi! But nor bi as I wont, na as yu wont am.”
Explore Matiu 26:39
4
Matiu 26:28
bikos dis na my blood, wey bi di kovenant wey go make God forgive pipol dia sins.
Explore Matiu 26:28
5
Matiu 26:26
As dem dey chop, Jesus take bread kon tank God, afta e divide am, e give en disciples, kon sey, “Make una chop, dis na my body.”
Explore Matiu 26:26
6
Matiu 26:27
Afta, e take di cup kon tank God, den e give dem kon sey, “Make all of una drink from am
Explore Matiu 26:27
7
Matiu 26:40
Wen Jesus kom back, e kon si sey all en disciples dey sleep. Den e ask Pita, “So yu nor fit stay make yu nor sleep for one hour?
Explore Matiu 26:40
8
Matiu 26:29
I tell una, from naw go, I nor go drink dis wine until di day wey I go drink di new wine with una for my Papa kingdom.”
Explore Matiu 26:29
9
Matiu 26:75
Den Pita kon remember wetin Jesus tell am, “Before fawol go make ‘Kukuruku’, yu go deny mi three times.” So Pita go outside bigin kry.
Explore Matiu 26:75
10
Matiu 26:46
Make una stand up, make wi dey go. Si! Di pesin wey won sell mi, don dey kom!”
Explore Matiu 26:46
11
Matiu 26:52
Den Jesus tell am, “Put yor swod for where e dey before! Bikos anybody wey dey karry swod, na swod go kill-am.
Explore Matiu 26:52
Home
Bible
Plans
Videos