1
Joshua 10:13
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
Di sun and di moon stand for one place as Israel pipol kill all dia enemies. Dem rite dis tins wey happen for Jasha Book (wey mean Raitious Book). Di sun nor move for di sky centre and e shine for one full day.
Compare
Explore Joshua 10:13
2
Joshua 10:12
Di day wey God put Amor pipol for Israel pipol hand, dat day Joshua pray to God for Israel pipol front sey: “Yu sun, make yu stay for where yu dey on-top Gibeon! And make di moon nor near dis side, just stay for where yu dey for Aijalon Valley!”
Explore Joshua 10:12
3
Joshua 10:14
Dat kind tin neva happen before and e nor happen again. God listin to one man, bikos E fight for en pipol, Israel!
Explore Joshua 10:14
4
Joshua 10:8
God tell Joshua, “Make una nor fear, bikos I dey give dem to una. Non of dem go fit stop una.”
Explore Joshua 10:8
5
Joshua 10:25
Den Joshua tell dem, “Make una nor fear or shake. Make una get heart and dey strong, bikos God go do di same tin to all una enemies wey una dey fight against.”
Explore Joshua 10:25