1
Isaya 6:8
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
Den I hear God ask, “Who I go send? Who go bi awa messenja?” So, I kon ansa, “I go-go! Make Yu send mi!”
Compare
Explore Isaya 6:8
2
Isaya 6:3
Each of dem dey sing dey sey, “holy, holy, holy! Na God wey get pawa, dey holy and en glory full di world.”
Explore Isaya 6:3
3
Isaya 6:5
I kon sey, “My own don finish, bikos evry word wey dey komot from my mout, na sin full am and I dey stay with pipol wey all dia words na sin and naw, I don use my eyes si Oga God wey bi di king wey get pawa.”
Explore Isaya 6:5
4
Isaya 6:1
For di year wen King Uzzaya die, I kon si vishon as God sidan for en throne wey get glory for heaven and en klot kover di temple.
Explore Isaya 6:1
5
Isaya 6:7
E use di hot shako take tosh my lips kon sey, “Dis tin don tosh yor lip, so from naw, yu don dey klean, bikos God don forgive yu.”
Explore Isaya 6:7
6
Isaya 6:2
Di kind creatures wey stand near am, dey bring out fire from dia mout and each of dem get six-six feada. Dem kover dia face with two feada; use two kover dia leg, den dem dey use di oda two take dey fly.
Explore Isaya 6:2
7
Isaya 6:6
Den one of di creature fly kom meet mi for groun and e use big sizos take hold shako wey dey burn and na from di altar e for karry am kom.
Explore Isaya 6:6
8
Isaya 6:9
So E tell mi make I go give di pipol dis message: “E nor get as una go listin rish, una nor go undastand. E nor get as una go look rish, una nor go know wetin dey happen.”
Explore Isaya 6:9
9
Isaya 6:10
Den E tell mi, “Go make dis pipol get strong heart, deaf dia ear and blind dia eyes, so dat dem nor go si, hear or undastand again. If dem bi like dat, dem go turn kom meet mi and I go heal dem.”
Explore Isaya 6:10
Home
Bible
Plans
Videos