1
Isaya 1:18
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
Afta una don do like dat, den God go sey, “Make una kom make wi setol di matter naw. Even doh una don stain unasef with blood bikos of una sin, I go wosh una white like snow. Even doh una stain red well-well, una go kon dey white like wool.
Compare
Explore Isaya 1:18
2
Isaya 1:19
If una obey mi, una go chop di good food wey di land dey produce.
Explore Isaya 1:19
3
Isaya 1:17
Make una learn to do good; make una make sure sey una dey judge well; make una help doz wey dem dey opress. Pipol wey nor get papa and mama, make una give dem wetin dem wont and make una help wimen wey dia husband don die.”
Explore Isaya 1:17
4
Isaya 1:20
But if una sin against mi, una go die. Mi, wey bi God, don tok.”
Explore Isaya 1:20
5
Isaya 1:16
Make una go wosh unasef klean and stop all di evil tins wey una dey do.
Explore Isaya 1:16
6
Isaya 1:15
Wen una raiz una hand dey pray, I nor go look una. Even if una pray many prayers, I nor go listin, bikos blood don stain una hand.
Explore Isaya 1:15
7
Isaya 1:13
Make una stop to bring una yuzles ofrins bikos di smell of di incense wey una dey burn, dey make mi vex. I nor wont una new moon festival; una Sabat and where una for dey gada woship mi, bikos sin don spoil all of dem.
Explore Isaya 1:13
8
Isaya 1:3
Melu know en owner, donkey sef know who dey gi-am food, but Israel wey bi my pipol nor know or undastand mi at-all.”
Explore Isaya 1:3
9
Isaya 1:14
I hate una new moon festival and di oda feast wey una dey celebrate, don taya mi. I nor fit bear dem again.
Explore Isaya 1:14
Home
Bible
Plans
Videos