1
Exodus 6:6
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
“So tell Israel pipol sey, ‘Na mi bi Oga God and I go remove di load wey Egypt pipol put for dia head and dem nor go bi slave again. Na my pawa I go take save una and I go ponish Egypt pipol.
Compare
Explore Exodus 6:6
2
Exodus 6:7
I go take una as my pipol and I go bi una God. Den una go know sey na mi bi di Oga wey bi una God. Di One wey save una from Egypt pipol hand wen dem dey sofa una.
Explore Exodus 6:7
3
Exodus 6:8-9
I go take and give una di land wey I promise sey I go give Abraham, Isaak and Jakob. Na mi bi Oga God!’ ” Moses tell Israel pipol dis tins, but dem nor listin to am, bikos of dia sofa.
Explore Exodus 6:8-9
4
Exodus 6:1
Den Oga God tell Moses, “Naw, yu go si wetin I go do Fero. I go force am make e allow my pipol go. I go use my pawa take make am drive my pipol komot from dis land.”
Explore Exodus 6:1
Home
Bible
Plans
Videos