1
Deutronomi 28:1
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
If una really obey God kon keep en kommand wey I dey give una today, di Oga una God go make una high pass all di pipol for di world.
Compare
Explore Deutronomi 28:1
2
Deutronomi 28:2
Una go get all dis blessings if una obey di Oga una God.
Explore Deutronomi 28:2
3
Deutronomi 28:13
If una listin well to di Oga una God kommand and if una obey dem with kare, God go make una bi di head and nor bi tail and una go always dey on-top and nor dey under.
Explore Deutronomi 28:13
4
Deutronomi 28:12
God go send rain from en rish store kom meet una for di rite time and E go bless all di work wey una dey do. Una go dey give to many kountries, but una nor go ever borrow from dem.
Explore Deutronomi 28:12
5
Deutronomi 28:7
God go make una win una enemies wen dem attack una. Dem go from one side attack una, but dem go skata and run from una for seven side!
Explore Deutronomi 28:7
6
Deutronomi 28:8
God go kommand blessing for una aria and for evritin wey una dey do; yes, E go bless una for di land wey E dey give una.
Explore Deutronomi 28:8
7
Deutronomi 28:6
Anywhere wey una go and anytin wey una dey do, God go bless am.
Explore Deutronomi 28:6
8
Deutronomi 28:3
God go bless una towns and una fields.
Explore Deutronomi 28:3
9
Deutronomi 28:4
God go bless una shidren and una plants. E go still bless una animals and dia pikin wey dem go born.
Explore Deutronomi 28:4
10
Deutronomi 28:9
If una obey di Oga una God kommand kon do as E tok, E go make una en holy pipol, just as E promise sey e go bi.
Explore Deutronomi 28:9
11
Deutronomi 28:5
E go bless una basket and una plate.
Explore Deutronomi 28:5
12
Deutronomi 28:11
God go make una shidren, animal and plant many kon make una prosper for di land wey E promise una grand-grand papa sey, E go give una.
Explore Deutronomi 28:11
13
Deutronomi 28:10
Den evribody for di eart go si sey una bilong to God and dem go respet una.
Explore Deutronomi 28:10
14
Deutronomi 28:14
Make una nor turn from any of dis kommand wey I dey give una today or go follow and woship oda gods.
Explore Deutronomi 28:14
15
Deutronomi 28:15
But if una forget di Oga una God and una nor gri obey en kommand and laws wey I dey give una today, den all dis curse go kom meet una with full force
Explore Deutronomi 28:15