At wons, Absalom si some of David men. So Absalom enter en horse dey run and as e dey pass under one big oak tree, di tree branches kon hook en head and e struggol till e die, bikos di horse run leave am.
One among David men si am kon go tell Joab sey, “Awa oga! I si Absalom hang for one oak tree!”