One day, David wake-up from sleep for aftanoon kon waka go di roof. As e dey waka round for der, e si one woman wey dey baf for en house and e fine well-well. So e send messenja go find out who di woman bi. Leta, dem kon tell am sey na Batsheba, wey bi Eliam pikin and na Uriaya wey bi Hit pesin, bi en husband.