So Saul kommand en savants, “Make una go find any woman wey dey do majik kom, so dat I go-go ask am wetin go happen.” En savant ansa, “E get one majik woman for Endor.” Saul dress so dat pipol nor go know sey na en den e kon go with two of en men. Wen dem rish where di woman dey for nite, e kon sey, “Abeg, make yu use yor pawa take koll di pesin spirit wey I go tell yu.”