1
1 Kings 3:9
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
So, make Yu give mi wisdom to rule yor pipol with good mind and to know wetin dey good or bad. If not, how I go take rule dis yor many pipol?”
Compare
Explore 1 Kings 3:9
2
1 Kings 3:12
I go do wetin yu ask. I go give yu wisdom and undastandin wey pass di ones wey anybody don get before or go get afta yu.
Explore 1 Kings 3:12
3
1 Kings 3:11
so E tell am, “Bikos yu don ask for wisdom to rule well, instead of long life, propaty or make yor enemies die
Explore 1 Kings 3:11
4
1 Kings 3:13
Tins wey yu nor ask for, I go still give dem to yu. Till yu go die, yor propaty and respet go plenty pass di ones wey any king go ever get.
Explore 1 Kings 3:13
5
1 Kings 3:14
And if yu obey and keep my laws and kommand, just as David yor papa do, I go give yu long life.”
Explore 1 Kings 3:14
6
1 Kings 3:5
One nite wen Solomon dey Gibeon town, God kon appear and ask am for dream sey, “Solomon, make yu ask mi for anytin wey yu wont and I go give yu.”
Explore 1 Kings 3:5
7
1 Kings 3:7
“My Oga God, even doh I still dey yong and I nor sabi rule, Yu make mi take-ova from my papa as king.
Explore 1 Kings 3:7
8
1 Kings 3:10
God happy well-well, bikos of wetin Solomon ask for
Explore 1 Kings 3:10
9
1 Kings 3:6
Solomon ansa, “Yu show great love to David my papa wey bi yor savant and e dey good, dey respet and always dey honor Yu. Yu still show am yor great love wey nor dey end, wen Yu make one of en pikin king afta am.
Explore 1 Kings 3:6
10
1 Kings 3:8
I dey here with doz wey Yu choose as yor own; pipol wey nobody fit kount.
Explore 1 Kings 3:8
Home
Bible
Plans
Videos