1
1 Korintians 9:25-26
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
Pipol wey dey run, dey train well-well, so dat dem go win crown wey nor dey last, but wi dey run for crown wey go last forever. So I nor dey run for nor-tin and I nor dey follow breeze fight.
Compare
Explore 1 Korintians 9:25-26
2
1 Korintians 9:27
Instead, I dey kontrol my body kon make am my slave, so dat afta I don prish di Good News give odas, God nor go rijet mi.
Explore 1 Korintians 9:27
3
1 Korintians 9:24
Una nor know sey, wen pipol dey run, na only one pesin go win di race and di prize? So make una run, so dat una go fit win!
Explore 1 Korintians 9:24
4
1 Korintians 9:22
Wen I dey with pipol wey get weak faith, I dey live as dem dey live, so dat I go fit win dem. I dey do evritin wey I fit do, so dat I go fit win evribody wey I fit win, kom meet Christ.
Explore 1 Korintians 9:22
Home
Bible
Plans
Videos